Seun Kuti

From Wikipedia
Seun Kuti
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am11 January 1983 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
PapaFela Kuti Chenj-am
Broda an sistaFemi Kuti Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusaxophonist, singa Chenj-am
Instrumentsaxophone Chenj-am
Stai of song abi fimAfrobeat Chenj-am
Record labelKnitting Factory Records Chenj-am
Official websitehttps://www.seunkuti.net/ Chenj-am

Oluseun Anikulapo Kuti (dem bon am for 11 January 1983), wey plenti pipu sabi am as Seun Kuti, na Naija musik e dey sing an na im bi las bon wey bi man for Fela Kuti. Na im dey kontrol im papa forma band Egypt 80.

Tori abaut im life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na im bi smol pas insaid di pikin wey Fela Kuti bon, dem bon am in 1983. E lik to dey sing wen e dey five years old, wen e wan rish p nine years old, e don stat to dey pley wit im papa band, Egypt 80.

Fela Kuti kpai in 1997 an na Seun Kuti dey leed di Egypt 80 band.

In 2018, di band rilis album wey dem kol am Many Things. Na dis bi di fest band wey Femi Kuti rilis wit Egypt 80 band.

Femi Kuti dey insaid Calle's 13 song wey bi "Todo se mueve" (Everything Moves), On dia 2010 album Entre los que quieran.

In 2014, dem giv Seun Kuti Chans to pafom for Industry Nite at di fest time. In 2019, Kuti na visito on 85 to Afrika; di sekond album by Amerika rapper with Jidenna.

Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kuti join in di Occupy Nigeria, wey dem uze to tel govment sey dem no lik as dey komot fuel subsidy moni, na wen Ebele Goodluck Jonathan bi president di subsidy Mata hapun. In November 2020, na im dey front for insaid pipu wey wan trai kari Im papa parti - Movement if the people - e wan regista am onda Naija electoral bodi, INEC.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Seun bon pikin wey bi girl wit im waif on 16 December 2013, di pikin nem na Ifafunmike Adara Anikulapo-Kuti.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Many Things (CD & LP album, 2008, Tôt ou Tard, Disorient Records)
  • From Africa With Fury: Rise (2011, Knitting Factory Records/Because Music)
  • A Long Way to the Beginning (2014, Knitting Factory Records)
  • Struggle Sounds (EP, 2016, Sony Masterworks)
  • Black Times (CD & LP album, 2018, Strut Records)
  • Night Dreamer Direct to Disc Sessions (CD & LP, 2019, Night Dreamer Records)

Oda rekording[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Think Africa (12", 2007)
  • African Dreams EP (2022, with Black Thought)

Appearances[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • "James Brown" (on di album I'm Not Bossy, I'm the Boss by Sinéad O'Connor) (2014, Netweerk).

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]