Segun Odegbami

From Wikipedia

Patrick Olusegun Odegbami (bon 27 August 1952), pipul sabi am wel as Segun Odegbami. Na Naijà forma futbola wey pley as strika.

Hau E Tek Stat Lif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Odegbami fo 27 August 1952, fo Legos, Naijà. Jacob Adebola Odegbami (1911-2003) an Beatrice Bintu Abeke Odegbami (nèe Olotu) (1921-2018), bi im papa an Mama. Segun papa na Naijà buk writa Amos Tutuola famili. Na fo Jos, Pleateu Stet Odegbami tek gro.

Im Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Odegbami pley 46 times fo Naijà an e skore 23 goals fo Naijà futbol teem, wey mek am win im fes Afrika kop of Nation wey bi 1980 tournament fo im homland. Pipul sabi am wel dat time as di Mathematical, di way Wey e dey tek kari Bol an kros am mek plenti pipul sabi am. Segun pley fo IICC Shooting Stars fo Ibadan fo all im karier, fom 1970 rich 1984. Im las match na fo 1984 Afrika Champions kop final, wey dem pley wit Zamalek of Egypt. Pipul dey kol am Mathematical bikos e stodi Engineering fo The Polytechnic of Ibadan, wey stil bi Naijà Premier Institution.

Afta Im Futbol Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

Segun Odegbami fo 2007 sho fo Who Wants to be a Millionaire show wey Frank Edoho dey du. Im pley di show kon giv pipul wey no get di moni wey e win, Di Charity pipul na The little Saint Orphanage.

Fo September 2015, Odegbami tok sey e won bi di FIFA President.

Na inside June 2022, E du niu Radio Station wet bi Eagles 7 Sport Radio 103.7 fo Naijà.

Im Pasonal Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Odegbami bon di girl wey dey bi May7ven.

E get two brodas wey dey pley futbol. One of dem dey pley futbol fo Old Western Region fo im skul(Ebenezer Grammar School, Abeokuta), Di West Academicials,im Unifasiti, UNN Nuskka, an fo Stationery Stores futbol klob of Legos.Im oda broda Wole Odegbami, na forma Naijà playa wey pley fo 11 years. Segun Odegbami dey writ fo Newspaper an Magazine.

Im Honours[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shooting Stars

.Nigerian Premier Leaque: 1976, 1980, 1983,

.Nigerian FA Cup: 1977, 1979

. African Cup Winners' Cup: 1976

Nigeria

.All African Games: Silver medal 1978

.Africa Cup Of Nations: 1980

Individual

.African Cup Of Nations goalscorer: 1978, 1980, (wit Khalid Labied) wit 3 goals.

.Africa Cup Of Nations Team of the Tournament: 1980.