Raymond Dokpesi

From Wikipedia
Raymond Dokpesi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejRaymond Dokpesi Chenj-am
Fest nemRaymond Chenj-am
Official nameRaymond Dokpesi Chenj-am
Wen dem bon am25 October 1951 Chenj-am
Wen e kpai29 May 2023 Chenj-am
Pesin wey e mariTosin Dokpesi Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Gdańsk, University of Benin, Loyola College, Ibadan Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Raymond Anthony Aleogho Dokpesi ( dey bon am 25 October1951 an e Kpai on 29 May 2023) na Naija pesin wey dey into T.V an redio bizness or make mass midi ha biziness. Na Dokpesi get Daar Communications kompini wey dey kontro Africa Independent Television, (AIT). E bi chairman of di hoganisin komitee of di People's Democratic Party wey happun for 2015.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Ibadan wey de Naija dey bon Raymond Anthony Dokpesi on 25 October 1951. Dokpesi paret kom from Agenebode wey de Edo Stet. Dokpesi papa an mama bon seven pikin-dem. Dokpesi get six sista.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dokpesi go Loyola kolej Ibadan. Leta, e go Immaculate Conception College (ICC) wey de Benin. For ICC, e bi one of di pipo wey start Ozolua Play House. Ozolua Play House na dans an drama group. Dokpesi go Yunivasiti of Benin, Edo Stet, but na for e finish e Yunivasiti edukeshon for Yunivasiti of Gdansk in Poland. Na for Yunivasiti of Gdansk Dokpesi tek do e Ph.D in Marine Enjinerin. Dokpesi enjoi free edukeshon fro sekondiri to yunivasiti bikos na halaji Bamanga Tukur dey pay e skul moni. In di 1990s, di govamet law tok sey na onli dem go dey tok Niuz. For Naija dat time, na onli T.V an redio stashon wey govamet get dey tok Niuz. Wen General Ibrahim Babangida bikom di presidor, e tok sey eni bodi wey get di moni fit get T.V an redio stashon wey dey tok Niuz. Di fest T.V stashon wey pesin wey no de govamet wan get for Naija na Dokpesi stashon, Africa Independent Television, (AIT). AIT bi di fest Satalite Televihon Stashon in Afrika. Na Dokpesi fest stat T.V an redio stashon wey govamet no dey chuk mouth for Naija. Dokpesi tok sey na e stashon helep arrenj how prisenta dey kolet beta salari wey odas TV stashon like NTA (Nigerian Television Authority) kom kopi leta.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dokpesi fest wok as di PA (pasonal hasistas) for halaji Bamaga Tukur. Halaji Bamaga Tukur na one of di jenera manija of NPA ( Nijiria Pot Ortoriti). Dokpesi don also wok as govamet workas in di Fediral Ministri of Transport onda Halaji Umaru Dikko an Jeneral Garba Wushishi.

Africa Ocean Lines[chenj-am | chenj-am for orijin]

Africa Ocean Lines bi di fest biziness wey Dokpesi fest do. Di kompini bi di fest shipin kompini wey Afrika pesin wan get in di hol of Afrika.Na for 1980s Dokpesi Start Africa Ocean Lines. Di biziness leta skata, but helep Naija shipin indostrie bikos e stat di law wey dey kontro shipin biziness as e dey Nigerian Shipping Act Decree 1986. An dis start di 40:20:20 for load wey dey kom from oyinbo land to Afrika land.

Daar Communications[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dokpesi start di fest redio stashon wey pesin wey no de govamet get Raypower in 1994. In 1996, e start di fest T.V stashon wey no bi govamet stashon in Naija AIT.

Palava abaut am[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 4 October 2010, Dey harest Dokpesi sey e hand de di Abuja car bombing. Afta nine hours wey e enta polis hand,dey kom rilis am mek e dey go. Dokpesi kom kari Naija Polis go kot for wetin dem do am. Dokpesi komplain to di politika parti wey e de PDP bikos of sey dey chuz Goodluck Jonathan to bi di pesin wey go bi dia kandidet for presidor eleshon.

Sikness an how e tek kpai[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2020, Dokpesi an memba of e famili kach di Korona vairus, COVID-19 an dey kari dem go Yunivasiti of Abuja Tishin Hospitu. Dey tel Dokpesi an two of e gran-pikin sey mek dey go home afta wey di disis don komot from dia bodi on 14 May, 2020. Na Stroke kill Dokpesi on 29 May 2023. Dokpesi na 71 year old wen e kpai.

Awod an Honor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di vilej wey Dokpesi tek kom give am two shif taitu. Dey menshon Dokpesi nem dorin Dr Kwame Nkrumah lidaship awod serimoni in Accra E nem stil kom out for "Foundation for Excellence in Business Practice" wey hapun for Geneva Switzeland for di wok wey e do for e kompini "Daar Communication"