Olarewaju Abayomi
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Country for sport | Naija |
Nem for lokal langwej | Olarenwaju Kayode |
Orijina nem | Olarenwaju Ayobami Kayode |
Fest nem | Olarenwaju |
Famili nem | Kayode |
Wen dem bon am | 8 May 1993 |
Ples wey dem bon am | Ibadan |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | association football player |
Position played on team / speciality | forward |
Wen e stat wok | 2010 |
Sport | association football |
Sport number | 8 |
Olarewaju Ayobami Kayode (dem bon am on 8 May 1993) na Naija ogbonge playa wey dey pley front for Turkish klob Gençlerbirligi
Hau e tek stat
[chenj-am | chenj-am for orijin]Kayode stat im bol wok for Red Bull Ghana an dey sign am on February 2010 for ASEC Mimosas.
On 2 February 2012 Kayode komot for ASEC Mimosas [1] go Swiss klob FC Luzern on loan rish 30 November 2012.
Im klob wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Maccabi Netanya
[chenj-am | chenj-am for orijin]On October 10 2013, Kayode sign one year kontrat wit Israeli klob Maccabi Netanya.
Austrian Wien
[chenj-am | chenj-am for orijin]Wen e du wel for Maccabi Netanya, wia e score 13 goals an hep som playa score six goals, Kayode kon go sign four year kontrat wit FK Austria Wien. Na on di 2 August, 2015 e score for di first taim for dem wen dem pley wit SC Rheindorf Altach.
Manchester City
[chenj-am | chenj-am for orijin]On 17 August 2017, Manchester City saign Kayode for four years an kon loan am go Girona for di 2017 - 18 season. Kayode first pley insaid La Liga on 19 August 2017, wen e enta for Portu insaid match wey dem pley 2-2 for home wit Atletico Madrid.
On 2 March 2018, dem loan Kayode go Ukrainian Premier League klub Shakhtar Donetsk afta dem kut im loan for Girona.
Shakthar Donetsk
[chenj-am | chenj-am for orijin]On 18 June 2018, Shakthar Donetsk tok sey dem go lik saign Kayode bikos of hau e tek pley wel wel for dem. Shakthar Donetsk leta saign am wit moni wey dem no let pipu kno for five years deel.
Gaziantep
[chenj-am | chenj-am for orijin]On 9 August 2019, dem loan Kayode go Turkish League said Sivasspor. Im fest goal for Sivasspor na for one Europa League match wit Villarreal, dem luz di match for dia home 5-3.
How e tek pley for kontri
[chenj-am | chenj-am for orijin]Kayode pley for Nigeria U17 Nashonal team for di 2009 FIFA U-17 Wod Kop. On 3 May 2010, Naija kol am to kon pley for U20 team for di Afrika Youth Championship for Libya. Dem kol am on 12 April 2011 for di 2011 Afrika Youth Championship insaid South Afrika. Kayode fest pley for Naija insaid sinior team on 23 March 2017, insaid match wey dem pley wit Senegal, Dem draw di match 1 - 1.
Im pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Insaid May 2024, Kayode go du DNA test for hol im three pikin wey sho sey no bi im bi dia papa.
How e tek wok for teble
[chenj-am | chenj-am for orijin]Club | Season | League | National Cup | League Cup | Other | Total | ||||||
---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|
Division | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | ||
Luzern (loan) | 2011–12 | Swiss Super League | 1 | 0 | 0 | 0 | — | 0 | 0 | 1 | 0 | |
Maccabi Netanya | 2013–14 | Liga Leumit | 25 | 10 | 4 | 1 | 0 | 0 | 0 | 0 | 29 | 11 |
2014–15 | Israeli Premier League | 31 | 13 | 1 | 0 | 2 | 0 | 0 | 0 | 34 | 13 | |
Total | 56 | 23 | 5 | 1 | 2 | 0 | 0 | 0 | 64 | 24 | ||
Austria Wien | 2015–16 | Austrian Bundesliga | 34 | 13 | 3 | 0 | — | 0 | 0 | 37 | 13 | |
2016–17 | Austrian Bundesliga | 33 | 17 | 3 | 2 | — | 12Templet:Efn | 5 | 48 | 24 | ||
Total | 67 | 30 | 6 | 2 | — | 12 | 5 | 85 | 37 | |||
Manchester City | 2017–18 | Premier League | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 | 0 |
Girona (loan) | 2017–18 | La Liga | 12 | 0 | 1 | 0 | — | — | 13 | 0 | ||
Shakhtar Donetsk (loan) | 2017–18 | Ukrainian Premier League | 6 | 2 | 2 | 1 | 0 | 0 | 0 | 0 | 8 | 3 |
Shakhtar Donetsk | 2018–19 | Ukrainian Premier League | 10 | 1 | 2 | 0 | 0 | 0 | 4Templet:Efn | 0 | 16 | 1 |
Gaziantep (loan) | 2019–20 | Süper Lig | 27 | 10 | 2 | 0 | – | – | 29 | 10 | ||
Sivasspor (loan) | 2020–21 | Süper Lig | 33 | 6 | 2 | 1 | – | 5Templet:Efn | 4 | 40 | 11 | |
2021–22 | Süper Lig | 33 | 6 | 5 | 0 | – | 6Templet:Efn | 2 | 44 | 8 | ||
Total | 66 | 12 | 7 | 1 | — | 11 | 6 | 84 | 19 | |||
Career total | 244 | 78 | 25 | 5 | 4 | 0 | 29 | 11 | 299 | 94 |
International
[chenj-am | chenj-am for orijin]National team | Year | Apps | Goals |
---|---|---|---|
Nigeria | 2017 | 4 | 0 |
2018 | 0 | 0 | |
Total | 4 | 0 |
Wia dem gada tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "KAYODE Olarenwaju: ASEC Mimosas - Le site officiel". asec.ci. Archived from the original on 1 August 2009. Retrieved 23 May 2023.