Olanrewaju Durodola

From Wikipedia
Olanrewaju Durodola
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Nik-nemGod's Power Chenj-am
Wen dem bon am1 October 1977 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbuja Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duboxer Chenj-am
Sportboxing Chenj-am
Sports discipline competed inheavyweight, cruiserweight Chenj-am
Participant in2008 Summer Olympics, 2006 Commonwealth Games Chenj-am

Olanrewaju Durodola(dem bon am for 16 October 1980) na Naijá bossa wey sabi fight wel wel.Olanrewaju hod Afrikan kruiserweight title for February 2020. E bin di WBC Silva kruiserweight title from 2015 go rish 2016. E stil go di 2008 soma olimpiks an 2009 Wod shampionships for hevyweight.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

For di 2006 komonwealth Games, Camille Michel wey komefrom Seycheles bit am 29:29. Durodola no fight for di 2007 ol-Afrika Games but e kwalify for di 2nd AIBA Afrikan 2008 Olimpik kwalifying Tornament as e bit Yekeni an som pipul. Di onli Olympic mach wey e kwulify for. E lose am to Osmay Acosta wey kom from kuban an na Akosta stil go win bronze medal for dat olimpiks. E sabi do knockout wel wel, na wetin e yus fight pipul wey no too sabi fight an na wetin e yus win dem. For 2011, Durodola don bikom beta fighta. E fight I'm fes kwarret fight for 19 Febuary for Memorial Hol wey dey for Kansas siti, Kansas. Dem leta kansu di fight bikos di pesin wey im wan fight komot hand wen time don almost rish. For 2013, Durodola win di WBC kontinentals Amerikas krusier Weight Shampionship kop an WBC Siva kruiserweights Shampion.