Obolo langwej
Obolo lanwej (wey some pipul stil de kol am Andoni lanwej ) na one of di Lower Cross lanwej. Dem dey spik am for Andoni LGA wey dey Rivers State, for Eastern Obolo LGA wey dey Akwa Ibom State an for some part of Ibeno LGA, all for Naija. Some Obolo pipul wey don komot go other parts of Ibeno dey spik am plenti for dat side also. For all di lanwej wey dey inside di group of Lower Cross langwej-dem, na Obolo langwej dey difren pas all di oda langwej.
How di lanwej dey
[chenj-am | chenj-am for orijin]The lanwej na agglutinative lanwej, wey be say, them dey join morphemes together take form words. E get some things wey be say if you mention only am, e no go mean anytin, so you go need gom-gom that thing with anoda word make e make sense. Another thing about dis lanwej be say na SVO lanwej. That one mean say, di way dem de take arrange words for inside the lanwej, na subject go come first, verb go come follow am before object come last.
Some tins wey dey abaut di langwej
[chenj-am | chenj-am for orijin]- For all di 530 langwej wey dey Naija, na Obolo langwej bi nomba 23 lanwej wey get ful Bible. Dem fes poblish di niu testament for 1991, den kom poblish di ful one for 2012.
- Obolo Katolik Bible na im bi di fes for Naija wey dem arenj di way dem tek du Jerusalem Bible.
- Di langwej get novel, Mbuban Îchaka, wey bi di fes of e kind for Eastern Naija Delta. Dem poblish am for 2010.