Nyesom Wike

From Wikipedia
Nyesom Wike
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejEzenwo Nyesom Wike Chenj-am
Orijina nemEzenwo Nyesom Wike Chenj-am
Famili nemWike Chenj-am
Wen dem bon am24 August 1967 Chenj-am
Pesin wey e mariEberechi Wike Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, lawyer Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Rivers State Chenj-am
Wie e go skulRivers State University of Science and Technology Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
ReplacesRotimi Ameachi Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Ezenwo Nyesom Wike CON (dem bon am on 13 December 1967) na Naija politishian an lorya wey sarf as govnor for Rivers State fom 2015 rish 2023. Na Ikwerre pesin fom Rumuepirikom in ObioAkpor, Rivers State. Na memba of People's Democratic party an e go Rivers State Universiti of Science an Technology.

Wike na two- term Exekutiv Chairman of Obio Akpor Lokal Govment Aria fom 1999 rish 2007. Na im bi di Minista of State of Edukashon on 14 July 2011. Wike leta bi di short taim Minister of Edukashon, afta dey sack Ruqqayatu, e kon resaign to go du campign for Govnor of River State. Na Vivian Onwuliri reples am. In 2014, e win di Rivers State People's Democratic party primari an chuz forma Secretary to di stet Govment Ipalibo Banigo as im deputy govnor. Wike win Dakuku Peterside of di All Progressive Congress (APC) an Tonye Princewill of di Labour Party in 11 April Govnor eleshon. In March 2022, Wike tok sey e wan go bi Nigeria President onda People's Democratic party insaid di 2023 General Eleshon, Atiku Abubakar win am for primari wit 371 votes an Wike get 271 votes. President Bola Tinubu mek di forma River's stet govnor Nyosom Wike FCT Minista, afta senate don chek am an aprov am.

Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wike go Government Sekondri Skul Eneka, wey dey Obioakpor. Rivers State. Na dia e du im O'level exam bifor e kon go Rivers State University of Science an Technology (RSUT). E get Bachelor of laws digre fom Rivers State University of Science an Technology afta dat one e kon go lor skul in 1997. Wike get Master of Arts digre in Politika Administrative Studies fom Rivers State University of Science an Technology.

Hau e tek wok for politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wike stat im politis wok as di Exekutiv Chairman of Obior Akpor Lokal Govmet Aria in Rivers State in 1999, e dey di post til 2007, e kon stil enta in 2003. In 2007, na im bi di chief of staff to di govnor of Rivers State, Rotimi Ameachi. In July, 2021, dey mek am di Minista of Stet for Edukashon by President Goodluck Jonathan an leta bi di fediral Minista of Edukashon in September 2013. E kon leta komot go du campign to bi River State Govnor in 2015. On 27, July2023, Wike nem dey insaid pipu wey senate chek wey fit bi Minista.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Breaking Tinubu Appoints Wike Minister of FCT Umahi mMnister of Works. Punch Newspaper retrieved. Retrieved 21 August 2023.