Rotimi Ameachi

From Wikipedia
Rotimi Ameachi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am27 May 1965 Chenj-am
Ples wey dem bon amIkwerre Chenj-am
Pesin wey e mariJudith Amaechi Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, lawyer Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Rivers State, Minister of Transportation, Minister of State for Transportation Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Port Harcourt, Baze University Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party, All Progressives Congress Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am

Chibuike Rotimi Ameachi CON (dem bon am on 27 May 1965) na Naija politishan, e don sarf as di Fediral Minista of transportation of Nigeria fom 2015 rish 2022 onda President Muhammadu Buhari. E komot for di wok of minista to go trai bi di president of Nigeria onda All Progressive Congress (APC). E don sarf as govnor for Rivers State fom 2007 rish 2015 an na im bi di bifor bifor spika of di River Stet Haus of Assembli fom 1999 rish 2007.

On 19 April 2022, Ameachi tel di poblik sey e wan go for president of Nigeria insaid 2023 presidensha eleshon, na im Kari sekond for di primari All Progressive Congress (APC) du for pipu wey wan bi president, na Bola Ahmed Tinubu kari fest wey kon mek am win wit 316 votes.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ameachi for Ubima, Ikwerre Lokal Govmet Aria of Rivers State to di famili of Elder Fidelis Ameachi an Mary Ameachi wey don kpai. Na for Diobu e tek gro, wey plenti pipu dey sta an e dey klose to Port Harcourt.

E stat im edukashon for St Theresa's Primari Skul fom 1970 rish 1976. E get in West Afrika Sinior Skul Certifikate in 1982 afta e don go Govmet Sekondri Skul Okolobiri. Ameachi get Bachelor of Arts digre (Honors) in English Studies an Literature fom do Universiti of Port Harcourt in 1987, wia im bi Nashonal Union of Rivers State Students (NURSS) president.

E finish im Nashonal Youth Service Corps (NYSC) in 1988, an afta dat one e kon join Pamo Clinics an Hospitals Limited wey bi Peter Odili get, e wok dia rish 1992. Im bi directo for plenti kompinis, lik West Afrika Glass Industry Limited an Risonpalm Nigeria Limited.

On 19 November 2022, Ameachi anous sey e don get finish as lor students for im Twitter account.

Hau e tek stat wok for politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen dey wan enta Third Nigerian Repoblik, na Ameachi bi di secretary of di Nashonal Repiblikan Convention in Ikwerre Lokal Govmet Aria of Rivers Stet. Insaid 1992 an 1994, na im bi di speshial assistant to di deputy govnor of Rivers State, Peter Odili. In 1996, na im bi Rivers State Secretary of di Democratic Party of Nigeria (DPN) smol committee for General Sani Abacha taim.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

E mari Judith Ameachi an dey bon three pikin. Na Catholic an di Knight of di order of Saint John (KSJ) . On 27 May 2021, Ameachi rilis song wey e kol am 'Blessed The people The Lord has chosen as His Heritage, wit I'm waif, Judith Wen e dey du im 56th birthday.

Awords[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ameachi get nashonal honour of Commander of the order of Niger (CON).