Nuhu Ribadu

From Wikipedia
Nuhu Ribadu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am21 November 1960 Chenj-am
Ples wey dem bon amYola Chenj-am
Pesin wey e mariZara Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolice officer, lawyer, jurist, politician Chenj-am
Wie e go skulAhmadu Bello University Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am

Mallam Nuhu Ribadu (dey bon am for 21 November 1960) na forna Naija polis ofisa an politishan wey don bi Chairman of di "Petroleum Revenue Task Force". Ribadu don wok as di oga pata pata for EFCC (Economic and Financial Crimes Commission). EFCC na one govamet hoganasashon wey dey kach an ponish politishan an pipo wey chop moni or do wayo.

For April 2009, Ribadu bikom visit leshura for di Senta for Gobal Divelopmet. Ribadu run komot for Naija but e kom bak in 2010. In 2010, Ribadu tel evribodi sey e wan go di presidor posishon with di politika parti ACN (Arkshon Kongress of Naijiria). Na on 14 January 2011 Ribadu kom bi di kandidet of ACN wey go fight to be presidor of Naija in di eleshon.

Ribadu run komot from e parti ACN go anoda parti wey dey in kontro at dat time, PDP bikos e wan yuz PDP tek fight to bi di govno of Adamawa Stet. Adamawa Stet de di " North East"of Naija.