Nike Oshinowo

From Wikipedia
Nike Oshinowo
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemNike Chenj-am
Famili nemOshinowo Chenj-am
Wen dem bon am1966 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey duentrepreneur, socialite, model, beauty pageant contestant Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Essex Chenj-am
VictoryMost Beautiful Girl in Nigeria Chenj-am

Nike Oshinowo (dem bon am as Adenike Asabi Oshinowo for 1966) na Naijá pesin wey dey du tok sho, biziness pesin, foma pageant dareto nd fashion pesin. [1]

How E Tek Stat Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oshinowo gro for Ibadan an England, wey shi go boadin skul.E wan bi pesin wey dey wok inside plane or doktor,but na Politik matta e go rid for University of Essex. Afta Oshinowo finish e digri, kross Riva Stet chuz am to go represet dem for di most beautiful gal in Naijá an shi win di prize.E dey rekod sey Oshinowo bi di fest Yoruba gal to bi Most Beautiful Girl in Nigeria. (Dem giv am for 1990, but shi enjoi am til 1991). Na Hellen Prest (Ex Miss Nigeria) na im bi Oshinowo traina for di fashion sho. Me i pipul tok sey na di Wayo Wayo wry hapun for di sho mek am win di sho.Wen di time wey e wan finish as winna dey end, Oshinowo du one intaviu tok wey shi tok abaut di sho an why im bi di koret winna.

How Im Tek Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen shi win di most bitiful gal ifter n Naijá, Oshinowo go repiset Naijá for Miss Wold.Osinowo du advatismet for Venus de Milo cream and lotion an host fashion sho for Naijá.Oshinowo opun bizness wey bi Afrika restorant and skin dip, helt an beauti spa for seven years. Afta Seven years dey sel di bizines. Oshinowo kom stat to mek e own beauti kream prodot to sel for Naijá pipul. For January 7, 2020, Oshinowo riliss wokout vidio wey shi nem Nike Oshinowa-Forty and Fabulous. Dis vidio bi di fest fitness vidio wey go kom out fom Naijá.Oshinowo stil get plan to mek beauti podot-dem. For 2010, afta six years to get am, shi buy di right to Miss Nigeria Franchise.Wen shi buy am, Oshinowo kom bi di Exekutiv Dareto . As of 2012, e no bi di executiv Dareto again. Shi stat to wok on fomin anoda fashion sho wey di winna go bi oga for hundred years. For 2014, Oshinowo stat anoda tok sho wey bi Late Night with Nike Oshinowo for AIT.

Pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oshinowo Sabi spik five langwej(English, Yoruba, Japanese, Spanish, and French). Oshinowo mari medikal doktor wey e nem na Tunde Soleye for 2006, but di mariage don end now. For 2009, di foma wife of doktor Soleye Kari dem go kot sey dem dey slip togeda even whe Tunde stil bi e hosband. For 2013, Oshinowo tok abaut one sikness wey dey du am sice 13 year old wen e stil dey sekondiri skul. Di nem of di sikness bi endometriosis. Wen shi dey 47 years old, anoda wuman Kari belle for Oshinowo an di wuman bon twins for Oshinowo an dis tin happun for Amerika.

Were dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. https://www.vanguardngr.com/2013/10/its-twins-for-nike-oshinowo/