Mike Adenuga

From Wikipedia
Mike Adenuga
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejMichael Adeniyi Agbolade Ishola Adenuga Jr Chenj-am
Fest nemMike Chenj-am
Famili nemAdenuga Chenj-am
Wen dem bon am29 April 1953 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dubusinessperson, entrepreneur Chenj-am
Pat of wok wey e put mindadministrator, entrepreneur Chenj-am
Wie e go skulPace University, Northwestern Oklahoma State University, Comprehensive High School, Aiyetoro Chenj-am
Academic degreeBachelor of Science Chenj-am
Academic majorbusiness management Chenj-am
Wie e dey livBanana Island Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Awod wey e koletOrder of the Niger Chenj-am
Official websitehttp://mikeadenugafoundation.org/ Chenj-am

Cheif Michael Adeniyi Agbolade Ishola Adenuga Jr CSG GCON (dem bon am on 29 April 1953) na Naija billionaire biznesman, an na im bi di third pesin wey get moni pas for Afrika. Im kompini Globacom bi Naija sekond telecom kompini wey big pas an e get branch for Ghana an Benin. E get share for Equitorial Trust Bank an oil stil get for Conoil.

Forbes chek im wealth an dey sey e rish $6.2 billion as of May 2021.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Im papa Oloye Michael Agbolade Adenuga Sr, na skul ticha an im mama, Omoba Juliana Oyindamola Adenuga (née Onashile, Okesopin, Ijebu Igbo), na bizneswuman fom royal Ijebu famili. Na Yoruba pesin.

Adenuga du sekondri edukashon for Ibadan Grammar Skul, Ibadan, Oyo Stet, Nigeria an Comprehensive High Skul, Aiyetoro, for im Higher School Certificate (HSC), e wok as taxi driva to tek du im universiti edukashon. E finish fom Northwestern Oklahoma State University an Pace University, New York, wia e tek get digre in Biznes Adminstrashon.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adenuga mek im fest million in 1979, Wen e dey 26, e dey sel klot an drink. In 1990, e get license to dey drill an 1991, e stat oil biznes insaid Ondo Stet, wey mek am fest pesin wey go stat oil biznes for di plez

Dem giv am GSM license in 1999. Afta dem kolet am bak, e kolet sekond one Wen govmet being am out for pipu insaid 2003.

Dem giv am African Entrepreneur of The Year at di ferst African Telecoms Awards (ATA) in August 2007.

Insaid May 2015, Adenuga trai buy Cote d'Ivoire mobile telecom kompini Comium for $600 million.

Honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2012, dem giv am Grand Commander of di Order of the Niger by di govment of Nigeria.

E get Yoruba tribe chieftaincy as di Otunba Apesin of di Ijebu Land.

In 2018, dem giv am Commander of the Legion of Honor by President Emmanuel Macron of France

Adenuga nem dey as one of the Top 100 most influential Afrikans by New African magazine in 2019.