Johnny Drille

From Wikipedia

John Ighodaro (dey bon am 5 July 1990) wey pipo no wel wel as Johnny Drille na Naija singa an song raita. Pipo start no Johnny wen e sing di song wey Di'ja don sing bifor Awww. Na Mavin Rekod sahin Johnny Drille.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Edo State wey de Naija dem tek bon Johnny on 5 July 1990. Johnny papa na sekondiri skul prinsipa an also a pastor. Na four pikin Johnny peret bon. Wen Johnny stil bi smol pikin, e dey join sing for e papa chorch.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Johnny start to dey sing for inside Chorch.

  • 2013

Johnny enta di sisin 6 of Projet Fame West Afrika kompetishon in 2013.

  • 2015

Johnny sing "Awww", di song wey Di'ja don sing bifor. Don Jazzy wey bi oga patapata for Mavin Rekod. E rilis e fest song Wait for Me in 2015. Di song risiv nominashon for Best Hotanetiv Song at The Headies 2016. Johnny join Niniola wey fight too to win di sisin 6 projet fame sing one song kol Start All Over.

  • 2017

For February 2017, Johnny sahin a rekod deal with Mavin Rekods.

  • 2023

In September 3, 2023, e rilis e full habom wey get 14 song inside.

Habom[chenj-am | chenj-am for orijin]

List of studio haboms
Title Habom details
Before We Fall Asleep

Song-dem wey e don do[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 2015 – "Wait for Me"
  • 2015 - "Love Don't Lie"
  • 2016 – "My Beautiful Love"
  • 2016 - "Start All Over (Featuring Niniola)
  • 2017 – "Romeo & Juliet"
  • 2018 – "Halleluya" (featuring Simi)
  • 2018 – "Awa Love"
  • 2019 - "Forever"
  • 2019 - "Shine"
  • 2019 - "Finding Efe"
  • 2019 - "Papa"
  • 2019 - "Dear Future Wife"
  • 2019 - "Count on You"
  • 2020 - "Something Better"
  • 2020 - "Mystery Girl"
  • 2021- "Ova"
  • 2021 - "Bad Dancer"
  • 2021 - "Loving Is Harder"
  • 2021- "Odo"
  • 2021- "Sister"
  • 2021- "In the light"
  • 2021- "Sell my soul"
  • 2022 - "How Are You (My Friend)"
  • 2022- "All I'm saying"
  • 2022- " Love and life"
  • 2022- "Journey of our lives
  • 2023- "Believe me"
  • 2023- "The Best Part"

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Johnny na hosband of Rima Tahin. E wife na Muzik manija.