Edo Pipul

From Wikipedia

Di Edo pipul or Benin pipul na di grup of pipul wey dia horijina home na from Edo Stet for di Souta part of Naija. Dem dey spik di Edo langwej an na dem bi di pikin for pipul wey fom di Benin Empaya. Dem de veri klos an dem rilet wit oda grup-dem wey dey spik Edo languej-dem like: di Afemai, di Esan, Isoko an di Urhobo.

Benin an Bini na di nem wey di Portugal pipul yus koropshon tek giv dem, na from di wod Ubini wey don dey teh teh from di taim wey di Oba (ruler) Ewuare stil dey for trone.

Ubini na wod wey di minin na Vexation, wey bi sey na Prince Oranmiyan wey bi pikin to one rish rula for Uhe (Ife), na e yus di wod to diskraib di kind wahala wey e faze wen dem kol am to kom bi king for Benin. Di oda grup-dem wey join wit dem an dey stey togeda wit dem for di senta kom put koropshon for dem to dey kol Ubini kom hard for dem, dey kom stat to dey kol am Bini, an for 1485, for di time wey di pipul wey kom from Portugal stat tu do fine fine beed biznes wit Oba Ewuare dem kom even spoil di nem moh moh kom dey kol am Benin.

How Dey Tek Shie Dia Teritry Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Naija for Ẹdo Stet yu fit see Ẹdo Pipul, wey dem get dia nem from di rijion wey dey fest stey wen meni of dem stat tu dia tins dem akodin tu history, wey bi Benin City na die sti be di sentra kapita for dia homeland for all di Ẹdo pipul. Dey even get meni klos grub dem wey nie dem an dey rileted tu dem for di boundri wey dia govment rish for Ẹdo Stet. Meni of dis grup dem don trace dia histri go back to di siti senta wey bi Benin City an dem sii sey dem bi Benin pipul. Esampu na dia neboh dem laik di difrent Afemai wey bi smol grup, an di pipul wey dey for Ẹdo Stet an di Esan pipul, di Akoko Ẹdo pipul wey dey for di stet bohda dem.

Ẹdo Stet na part of bifor bifor Bendel state bifor kolonaizeshon for Naija, dem even no dem sey dem bi Mid-Western Region, for Naija. Dis rijion influens dia kolshor wey mek Ẹdo, Urhobo, Esan an oda pipul wey dey rileted tu Ẹdo kolshor kom resembu diasef.

Dia Dresin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ẹdo pipul get meni tins wey dem dey yus for fashon an e dey komon for dem tu yus red beed dem, tu dey wieh tin for dia leg round dia anku (anklets), an dem dey wieh klot dem wey dem mek from leef dem (raffia work) an meni oda tins dem laik dat.

Dia Biliv for Tradishon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ẹdo pipul tradishonal biliv for rilijion mata, tins wey dey insaid dia tradishonal rilijion pass dis awa human wold an na tins dem wey dey for invisibu wold wey eyes no fit see an dem dey intaven for pipul wey dey for di wold mata. Pipul wey dey wohship dem dey faind taim dey mek sakrifais for dem for dia difrent difrent shrine dem. God wey bi Osanobua na di krietor an na e get pawa pass dem all. Him pikin dem wey bi Olokun na dem dey rule all di bodi of wohta, an na dem dey responsibu for prospariti an fatiliti for pipul wey dey wohship dem. Ogun (god of iron), na e anoda pikin wey bi oga for pipul wey dey wohship di god of iron.

Di nem Osanobua Noghodua, wey di meenin na God Almighty. Osanobua na wod wey get meni fine fine meenin dem laik tu dey pity for pesin (merciful), e no get wie e stat an e no get wie e end (timeless), (goodness), (justice), an e dey pawaful (sublimity), na e high pas an get pawa pas evri tin (supreme) for wetin Ẹdo pipul biliv, Osanobua get holy karakta wey dem bi omnipresence (orhiole), omniscience (ajoana), an omnipotence (udazi). Dem biliv sey di pawaful God de dey for evriwie for evri taim.

Art an dia Kolshor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Foto of Oba Oguola, wey bi king fo Ẹdo

Ẹdo tradishon for art mata dey waed an dia wok na tu dey mek tins imej from wud or tu dey yus ston mek tins imej dem (sculptures), tins for awod dem (plaques), an tins wey pesin fit yus kova face (masks) wey dey sho spirishua an tins wey konsan dia histri for dia kolshoral tradishon dem. Som of di Ẹdo pipul art wok wey pipul sabi wey dey imphtant laik di mask of the Queen Mother Idia an di vast collection of historical Edo art pieces called the Benin Bronzes wey bi sey no bi for Naija alon you go see am but dem kari dem tu di oda part for di wold, yu go sii dia art wok dem for di musiom dem laik di New York's Metropolitan Museum of Art

Femos Benin pipul for Naija[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ewuare II : The 40th Oba of Benin Kingdom from 2016–present.

Esther Erediauwa : The first wife of the 39th Oba of Benin kingdom, Oba Erediauwa.

Victor Uwaifo : Musician, writer, sculptor, and musical instrument inventor.

Peter Odemwingie : Footballer.

Charles Novia : Professional film director, screenwriter, producer, actor and social commentator african.

Osayuki Godwin Oshodi : Vice-chancellor of former University of Benin.

Benson Idahosa : Founder of the evangelist, and Church of God Mission International.

Samuel Ogbemudia : Politician and former military Governor of the Mid-West State.

John Odigie Oyegun : Politician and first national chairman of All Progressives Congress (APC) in Nigeria.

Victor Ikpeba : Football professional.

Godwin Obaseki : Governor of Edo state (2015 to 2019 under APC, and from 2019 under PDP) and business man.

Gabriel Igbinedion : Nigeria business man and esama of Benin kingdom.

Erhabor Emokpae : Artists, director.

Mercy Aigbe : Is a Nigerian actress and filmmaker.

Guosa Alex Guosa Igbineweka' : Guosa Language Evolutionist, Creator: a Nigerian and ECOWAS indigenous zonal lingua-franca.

Abel Guobadia : Former Chairman of Nigeria's Independent National Electoral Commission.

Jane Igharo : Professor Nigerian-Canadian writer.

Osasere Orumwense : Vice Chancellor of University of Benin.

Suyi Davies Okungbowa : African fantasy and speculative fiction author.

Archbishop John Edokpolo : Honourable Minister of Trade and Founder of Edokpolor Grammar School.

Chief Jacob U. Egharevba : A Bini historian and traditional chief.

Rema : Music artist.

Kamaru Usman : Nigerian mixed martial artist.

Gbadamasi Agbonjor Jonathan ( Pikin) : Nigerian comedian MC Edo.

Wie Dem Gada di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]