Jump to content

Gun langwej

From Wikipedia
Gun langwej
natural language, modern language
Subclass ofGbe Chenj-am
Native labelGungbe Chenj-am
KontriBenin, Naija Chenj-am
Coordinate location6°30′0″N 2°36′0″E Chenj-am
Writing systemLatin script Chenj-am
Ethnologue language status5 Developing Chenj-am
Wikimedia language codeguw Chenj-am
Map
Vidio for Gun langwej wey dey introdus Gungbe Wikipedia

Gun langwej (Gun: gungbe) na langwej wey Ogu pipul wey dey for Benin Ripoblik an Naija dey tok. Gun langwej dey among di langwej grup wey dem dey kol gbe. Di langwej nia oda langwej laik Fon, Agbome, Kpase, Maxi an Weme (Ouémé). Na dis langwej dem dey tok pas for Benin an dem dey yuz am tich for som skul-dem for Ouémé Department for Benin.

Na Gun langwej dem dey tok pas for di pat of Benin Ripoblik wey dey for Saut for Porto-Novo, Sèmè-Kpodji, Bonou, Adjarra, Avrankou, Dangbo, Akpro-Missérété, Cotonou an ples-dem wey di Ogu pipul dey liv. Som smol Ogu pipul wey dey for Saut-West said for Naija sef dey spik Gun, espeshali for Badagry, Maun, Tube.[1]

Dem don rait Gon langwej for 3 difren difren stai. Di three stai kopi di Latin leta. For Naija, dem don yuz di stai wey luk laik di kain stai wey dem yuz rait Yoruba an oda langwej for Naija tek rait dis Gun langwej an dem dey yuz one smol dot for onda di tin wey dem rait so dat pipul go sabi hau to rid am. For Benin, dem yuz anoda rul tek rait Bible for 1923 an dem kom du am wel wel for 1975 an nau dem dey yuz am tich pipul hau to rid an rait for skul. E wan jost bi laik di langwej wey dem dey kol Fon, e dey yuz leta laik ⟨ɛ⟩ an ⟨ɔ⟩. E get som pipul wey dey du evritin wey dem fit du to bring som kain rul for hau to yuz di langwej. For ezampul, di one wey Hounkpati Capo tok for 1990.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. https://www.ethnologue.com/language/guw