Gun langwej

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Gun langwej
language, modern language
Subclass ofGbe Chenj-am
Native labelGungbe Chenj-am
KontriBenin, Naija Chenj-am
Indigenous toOuémé Department, Plateau Department, Federal Capital Territory, Lagos State, Ogun State Chenj-am
Located in the administrative territorial entityBadagry Chenj-am
Writing systemLatin script Chenj-am
Ethnologue language status5 Developing Chenj-am
Wikimedia language codeguw Chenj-am
Video for Gun language wey de introdus Gungbe Wikipedia

Gun langwej (Gun: gungbe) na langwej wey Ogu pipul wey dey for Benin Replublic an Naija dey tok. Gun langwej dey amog di langwej grup wey dem dey kol Gbe. Di langwej nia oda langwej laik Fon, Agbome, Kpase, Maxi and Weme (Ouémé). Na dis langwej dem dey tok pas for Benin an dem dey yuz am tich for som skul-dem for Ouémé Department for Benin.

Na Gun langwej dem dey tok pas for di pat of Benin Republic wey dey for South for Porto-Novo, Sèmè-Kpodji, Bonou, Adjarra, Avrankou, Dangbo, Akpro-Missérété, Cotonou an ples-dem wey di Ogu pipul dey liv. Som smol Ogu pipul wey dey for South-West side for Naija sef dey spik Gun, espeshali for Badagry, Maun, Tube.

Dem don rait di langwej for 3 difren difren rul wey dem tek dey rait an evri of dem stand on top di Latin alfabet. For Naija, dem don yuz som rul wey resembu di kain rul wey dem yuz rait Yoruba an oda langwej for Naija tek rait dis Gun langwej an dem dey yuz one smol dot for onda di wetin dem rait so dat pipul go no how to rid am. For Benin, dey yuz anoda rul tek rait Bibul for 1923 an dem kom du am wel wel for 1975 an now dem dey yuz am tich pipul how to rid an rait for skul. E wan jost bi like di langwej wey dem dey kol Fon, e dey yuz alfabet like ⟨ɛ⟩ and ⟨ɔ⟩. E get som pipul wey dey du dia best to bring som kain rul for how to yuz di langwej. For ezampul, di one wey Hounkpati Capo tok for 1990.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]