Badagry

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Badagry
local government area of Nigeria, Villa
Part ofSouthwest Nigeria Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityLagos State Chenj-am
Located in time zoneUTC+01:00 Chenj-am
Coordinate location6°25′0″N 2°53′0″E, 6°24′54″N 2°52′53″E Chenj-am
Office held by head of governmentChairman of Badagry local Government Chenj-am
Language usedGun langwej, Yoruba Langwej, English literature Chenj-am
Official website Chenj-am

Badagry (we dem de call Gbagli for lokal langwej) na one tanwn wey dey near di riva an na Lokal Government Eria (LGA) wey dey inside Legos Stet, for Naija. I dey very klos to di siti of Legos, and i dey for di north sid of one smal wota for Porto Novo wey bi di kapital of Benin wey join bodi enta Legos for Naija. I com stil konet ples like Legos, Ilaro and Porto Novo together, an i shie boda wit Republic of Benin. Wen dem kount di pipu we live die for 2006, di nomba dat tiem na 241,093. Badagry dey nie lagoon and ocean, dis one kom mek am bi di ples we plenti biznes hapun fo West Africa from 1736 to 1851, an bikos i get smal smal wota laik lakes we konet to the big wota, na im mek pipu com fit de bai and sel wel. For dat taim we dem dey bai an sel slev to oyinbo land, na di big sea we dem dey call ocean we de Badagry be di rod we konet di pipu wey dey buy an di pipu wey dey sel togeda.

Land we Badagry kova[chenj-am | chenj-am for orijin]

Badagry dey for di saut-west of Nigeria, di Gulf of Guinea for saut, i de 43 mails sauteast of Legos an 32 mails west to seme we bi bod tawn fo Benin Republic. Laik legos Island, Badagry dey nie big wota like lagoon we get road we pesin fit folow go Legos an Porto Novo. Di distans bitwin di lagoon and di ocean dipend on hau di land bi, bot fo Badagry di distans no pas 1 mail. Di lagoons fit go dawn rich 3 mitas an e fit com up rish 1 mita. Di lagoons get difren taips of fish laik: Bonga, Croaker, Longfin, Pompano, Tilapia and Catfish. Di wota fo di lagoon de changi kolo as di sizin dey chanj, iven YEWA riva de flow enta di lagoon we de Badagry from di West.

Tori abaut Badagry[chenj-am | chenj-am for orijin]

I get one Yoruba tori wey tok sey di fest pipu wey settle fo dis aria na Awori pipu we com from Ile-Ife. Robin Law, we sabi buk especialy fo West African histri tok se dis eria stat from pipu we run komot or we dem posu from die ples com setu fo die. Di Egun pipu, Ewe pipu an di yoruba pipu fo Oyo na pipu we com de live fo dis place.

Anoda tori tok se sum pipu we live fo one ples we dem de qcall Gberefu we de nie di Atlantic Ocean na di Ewe pipu we com from Oyo.

Hau Badagry bi from 1736 go reach 1840[chenj-am | chenj-am for orijin]

One of di tori wey pesin no go quick foget na abaut di area na one oyinbo man we de do biznes and e com get land for dis place. Di lokal pipu de cal di man YOVO HUNTOKONU, bot findings show se dis man na Hendrik Hertogh a biznes man we com from Holland.

Huntokonu e com to di west com setle fo dis eria bikos i de run from one African chief we de vex fo am. I rich the ples wie dem de cal Apa wie di Oba we be Alapa com give am land we i go use de do im bizness.

Badagry get i nem from di we pipu we de live die de survaive. Di main wok we pipu de do fo Badagry na Fishing, Farming an dem stil de do salt. Som pipu tink se di city get e nam from Agbede, one farmer we pipu no wel wel we giv im farm nam we bi Agbadarigi but di oyinbo pipu change am to Badagry.

Badagry bi like passage wey di white pipu com kari slaves’ dem pas go difrent kontris fo di earli Eighteenth Century. Di ples we dem biwud to honor di slaves na im dem de cal “POINT OF NO RETURN”, an dem put charm inside di wel we de die so dat if di slaves dem drink am, dem go forget hu dem bi.

Badagry gain from di fait ontop slave bizness we hapun between Porto Novo an Dahomey fo di end of Eighteenth Century. Bikos if fait hapun ontop any slave dat taim, na Badagry dem dey sel di slave come for chep pris.

Chief Mobee na one of di African Chief we do slave bizness for 1983. Dem biwud di fest two-storey for Marina, Badagry, for 1845.

Hau Badagry bi from 1840 go rich 1900[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bekos Badagry dey nie wota an e get road we pesin fit pas to enta Abeokuta and Oyo for im north side, i mek am posibu fo pipu from Sierra Leone an di Missionaries to enta am. Around 1837, sombodi we come from Sierra Leone we de go Methodist church rit one leta to de preach fo Badagry. Methodist church jus do missionary party finish for Gold Coast, so de com send som of dia membas to Badagry. The people we lid di parti na Thomas Birch Freman an Charles Degraft. Di Methodist Missionaries fest preach unda di Agia tree and leta de com biwud one bamboo church die.

For 1845, som pipu we bi de go CMS church an dey preach fo oda kontry dem com enta Badagry. Di group of pipu na Revs, Townsend, Crowther an Gollmer, two tisha from Sierra Leone, som kapentas an ol die waifs. Fo dia mind, dem bi won go Abeokuta bifo bot bikos one chief we im name na Sodeke die fo Abeokuta, de com dile for Badagry. Di group ste fo Badagry fo one an half year, de com biwud mission haus fo die wit two levuls.

As tins bi, di wey pipu de change to Christian fo di fest half of Nineteenth Century no plenti fo Badagry bikos of di local wahala we hapun between 1851 go rich 1854 an bikos Legos don bicom strong group of pipu pas Badagry. So, as Legos don bicom strong colony and Nigeria sef don de gada pawa, Badagry com lose im power ova Legos.

Di diferent-diferent quarters fo Badagry[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem divide Badagry to eight wods an ol di eight wods get tradisonal hed. Dem be Jegba (Akran, Di ruling haus),Asago (Bala), Ganho (Agoloto), Posuko (Possu), Boeko (Mobee), Ahoviko (Wawu), Ahwanjigo (Jengen), an Wharakoh (Vihento).

Hau Badagry be fo Twentieth century[chenj-am | chenj-am for orijin]

From 1953 go rich 1965, Badagry bi di divisional headquarters fo arias dem we dem fom fo Badagry laik Amuwo-Odofin, Ojo and Ajeromi-Ifelodun. Wen dem com bring Legos Stet Com fo 1967, dem use Badagry as one of di five administrative zone fo Legos Stet.

kulsure[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na plenti festiva dem de do fo Badagry, Dem dé dó Ajido Zangbeto Cult, Igunnuko Festiva an Badagry Diaspora and Heritage Festiva. Di Mama langueg of Badagry na Egun we Aja pipu de spik and dem stil de spik am fo Port-Novo. Badagry get religion we be laik vodum an dem stil get oda religion we dem de do. Na eviri quarters get dia own juju haus, laik Nabruku at Ijegba, Vlekete at Posukoh, and Mathe at Adariko. Bot fo Badagry we don open eye nao, na Muslim and Christian ful eviriwie.

Di kind wok we dem de do[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di wok dem fo Badagry na Fishing, Trading and Tourism. Bikos Badagry nia di sea, an ol di slave Bizness we don hapun for die an ol di tori we pipu de hia de mek dem com Badagry to com si hau i bi di haus we Thomas Birch Freeman biwud na im bi Fest Storey Building an di Methodist church we bi di Fest ples we Missionary dem ste fo Nigeria. Di Governor of Legos Stet we be Sanwo-Olu don tok se dem du one seaport fo Badagry. I tok say "ai don tel NPA say we nid 2 mor seaports fo Legos, one fo Lekki an one fo Badagry. Dem don Apruve di one fo Lekki but dem stil de tok abaut di one we go de fo Badagry".

Ples we de impotant fo Badagry[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Royal Palace Of Mobee na Relics Museum haus we dem biud fo Nineteenth Century. Na die dem show wetin Chief Mobee do abaut Slave mata fo Badagry an ol di tins we im son stil do to kontribut fo Slave mata fo Badagry. Di Museum hausis dem show proof say oyinbo pipu rily com Badagry and com use tins laik Moni, Gin, an any oda tins take kari awa pipu go as Slave. So if pipu go die, dem de tel dem abaut hau dem tek yolks, chains an handkufs tek sufa awa pipu fo dat taim. Ol di tins we i hapen dat taim stil get sum foto an image we de show wetin hapen, an pipu stil de use am tel oda pipu tori til now. Infact dem stil de selibret am til tode say dem don Free. Anoda ples we de impotant na di Fest Storey Biwuding we bi di ples we dem ste tek translat English Baibu to Yoruba. Di Point Of No Ritun de fo Gberefu, an na im bi di road we dem kari Slaves pas go oyinbo Land.

See dis one sef[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Badagry festival.
  2. Mowo, Badagry.
  3. Velekete Slave Market.

Photos dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wia we gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]