Ogu pipul

From Wikipedia
Ogu pipul
ethnic group
KontriNaija, Benin Chenj-am
Located in the administrative territorial entityLagos State, Ogun State Chenj-am

Ogu pipul wey som pipul dey kol Egun pipul, na one tribe wey dey for Lagos State an Ogun State for Naijá. Ogu pipul get difren-difren metod of spikin dia langwej wey som of dem na Thevi, Xweka, Ṣètò an Toli. Ogu pipul na abaut 15% of di pipul wey dey Legos an na dia Stet of orijin.[1]

Wie dey kom from[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ogun pipul na pipul wey dey liv for old Dahomey wey pipul dey kol Repoblik of Benin.Tori get am sey Ogu pipul orijin na Whydah, Allada an Weme.Whydah, Allada an Were dey Repoblik of Benin bikos of di fight fight (Dahomey war) wey happun in 18 Senturi. One pesin wey dey tok histri wey e nem na Mesawaku tok sey, Ogu pipul kom Badagry in di 15th Senturi bikos dey no wan dai bikos of di fight fight.

Aria wey we fit find dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Ogu pipul dey Badagry in Legos Stet, Yewa an Ipokia in Ogun Stet.Ogu pipul stil dey som pat of Repoblik of Benin.Sins Ogu pipul like to stey wie wota dey, meni of dem dey kash fish, dey du kokonut bizness an Salt bizness.Som Ogu pipul dey bai an sel an oda dey into farmin. Ogu pipul no dey yuz dia tradishion pley at all even sey dey get oda rilijion.You fit see Ogu pipul dey saf one god kol Zangbeto (A Nightman). Ogu pipul an Yoruba pipul jos bi like broda an sista bikos for 17th-18th Senturi, na Oyo Empire dey kontrol Dahomey Empire an dis mek di two tribe bi like broda an sista.

Buk-dem wey you fit rid about dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • J. A. Fiberesima (1990). Okrika: In Search of an Ancestry. Evans Brothers. ISBN 978-978-167-450-1.
  • A. Babatunde Olaide-Mesewaku; Babatunde A. Olaide-Mesewaku (2001). Badagry district, 1863-1999. John West Publications Ltd. ISBN 978-978-163-090-3.
  • Akinjide Osuntokun (1987). History of the Peoples of Lagos State. Lantern Books. ISBN 978-978-2281-48-7.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Segun Olatunji (27 December 2013). "Egun people blame underdevelopment on minority status". The Punch. Archived from the original on 27 December 2013. Retrieved 13 August 2015.