George Akume

From Wikipedia
George Akume
pesin
Part ofHouse of Representatives of Nigeria Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemGeorge Chenj-am
Wen dem bon am27 December 1953 Chenj-am
Fest langwejTiv Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Tiv, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Pat of wok wey e put mindBachelor of Science Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Benue State, Minister of Special Duties and Inter-Governmental Affairs, member of the Senate of Nigeria, member of the Senate of Nigeria, member of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Ibadan Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress, Peoples Democratic Party Chenj-am
E pipulTiv people Chenj-am

George Akume (dem bon am on 27 December 1953) na Naija politishan wey bi di 21st an niu Seketry to di Govmet of di Federashon, wey President Bola Tinubu chuz. E don sarf as Minista for Speshial Duties an Inta Govmetal Affairs wen President Muhammadu Buhari dey rul fom 2019 rish 2023. Na im bi di Senato wey dey stan for Benue North-West Senatorial District fom 2007 rish 2019. Na im stil bi minoriti leader for di Senate fom June 2011 rish June 2015. E don sarf as Govnor of Benue Stet fom May 1999 rish May 2007.

Akume enta di sekond taim as Senato for Benue North-West insaid di April 2011 eleshon, onda Action Congress of Nigeria. E win anoda term insaid 2015 kon lus to Senator Emmanuel Yisa Orker-Jev of di PDP in 2019. On July 2019, President Muhammadu Buhari menshon Akume nem as pesin wey go bi im Minista for Speshial Duties an Intergovernmental Affairs.

Hau e tek stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akume get bachelor's digre insaid sociology an a masta digre insaid Labour Relation fom di Universiti of Ibadan. E dey sta for insaid Abuja, Nigeria.

Politis wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hau e tek wok for stet govmet

Insaid 1999 na Akume bi di govnor of Benue Stet an sarf as two terms wey bi four years. E win eleshon to tek stan for di pipu of Benue Stet as Senato for Benue North-West insaid Naija Senate.