Genevieve Nnaji

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Genevieve Nnaji
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Industryfilm industry, cinema of Nigeria, entertainment industry Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejGenevieve Nnaji Chenj-am
Orijina nemGenevieve Nnaji Chenj-am
Fest nemGenevieve Chenj-am
Famili nemNnaji Chenj-am
Wen dem bon am3 May 1979 Chenj-am
Ples wey dem bon amMbaise Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts, film director, motion picture film Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos, Methodist Girls' School Chenj-am
Academic degreebachelor's degree Chenj-am
Academic majorcreative work Chenj-am
Wen e stat wok1987 Chenj-am
E pipulIgbo pipul Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
FilmographyGenevieve Nnaji filmography Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Genevieve Nnaji (dem bon am for May 3, 1979) na Naija aktres, produza, an direkto. Shi win di Afrika Movie Akademi Awod fo Best Aktres fo 2005, dis wan mek her di fes pesin to win di awod. Fo 2011, di govment honor Genevieve as Member of the Order of the Federal Republic fo ha kontribushun to Nollywood. Di fes movie wey Shi direkt wey di taitu na Lionheart, na di fes Netflix film from Naija an di fes Naija film submission fo di Oscars. Dem disqualify di fim bicos na English dem Tek tok fo most Pat of di fim instead of di lokal langwuej.Genevieve de among di celebriti dem an big big fo biznes wey di publisher an Editor in Chief of Yes International! magazine, Azuh Arinze, wrait abaut fo 2020 fo e tu neu buk.

Hau Shi stat laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Mbaise, Imo State, Nigeria, Dem bon Genevieve an Shi grow fo Lagos. Shi bi number four of eight children wey ha Mama an Papa bon. Ha father wok as engineer an ha mother wok as nursery school teacher.

Edukashun[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi attend Methodist Girls College (Yaba, Lagos), com go University of Lagos,were Shi get bachelor degree fo creative arts. Na wen Shi dey university, she don de audition fo akting job fo Nollywood.

Kariar[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na from small pikin Nnaji don stat to akt, na di popula televishun drama Ripples na im bi di fes fim Shi akt wen Shi bi 8 year. Fo 1998, fo di age of 19 Shi akt fo di fim wey di nem na Wanted. Other fim dem wey Shi akt na Last Party, Mark of the Beast, and Ijele. Fo 2010, Shi bi one of di main aktres fo di award-winning film Ijé: The Journey. She don akt fo over 200 Nollywood movi-dem. Fo 2004, Nnaji sign wan record contract with EKB Records; wey bi Ghanaian record label, an release her fes album wey di titu na One Logologo Line. Di song na mix of R&B, Hip-Hop, and Urban music. Fo 2004, na Genevieve Nnaji get vote pass other celebrity dem fo di search fo di face of Lux fo 2004. Fo 2005, she win di Africa Movie Academy Award (AMAA) fo Best Actress fo Leading Role, na Shi bi di fes aktor to win di award. Fo 2009, Nnaji na one of di woman aktor dem wey de kolect big money pass fo Nollywood. Bicos of wetin Shi do fo Naija movie industry, she become di fes actor wey dem give awod as Best Actress fo 2001 City Peoples Awards, bifo dem give ha, na only ogbonge politician and big biznes pipu dey get di awod. Na Shi still be di fes actor wey Censors Board of Nigeria go awod as Best Actress fo 2003. Fo 2009, Oprah Winfrey call ha di Julia Roberts of Africa. Fo November 2015, Nnaji mek ha fes movi " Road to Yesterday", dis fim win Best Movie Overall-West Africa fo di 2016 Africa Magic Viewers Choice Awards. Fo September 7, 2018, Netflix buy the right to di fim Lion Heart wey be di fes fim wey Nnaji direct. Na fo di 2018 Toronto International Film Festival dem release di fim to di world. Fo May 6, 2021, Genevieve Nnaji akt fo di skit wey Ofego produce wey di titu na "Say It And Quench" fo him YouTube channel. Genevieve Nnaji na pesin wey dey Kari woman mata fo head. Shi still dey push make Naija gel-dem dey free to choose who Dem go marry. Shi no supot mek gel-pikin dey marry early. Shi strongly dey against mek dem dey do woman-dem anyhow. Genevieve tok sey Shi like wel-wel mek everi-pesin dey get wetin Dem deserve. Genevieve Nnaji na strong feminist. She tok sey her own feminist na woman wey get right to mek her own choice and do wetin she feel like.

Model wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Genevieve na Model. Nnaji don do model wok fo plenty commercials like Pronto (beverage) and Omo detergent. Fo 2004, shi become "Face of Lux" fo Nigeria and plenty moni dey fo di deal. Fo 2008, Nnaji start ha clothing line "St. Genevieve", an dem sey dem go donates di profit to charity. Fo May 2010, dem appoint Nnaji to bi di "Face of MUD" fo Nigeria.