Frank Onyeka
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Country for sport | Naija |
Nem for lokal langwej | Frank Onyeka |
Orijina nem | Ogochukwu Frank Onyeka |
Fest nem | Frank |
Famili nem | Onyeka |
Wen dem bon am | 1 January 1998 |
Ples wey dem bon am | Maiduguri |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej, Igbo langwej |
Wok wey e dey du | association football player |
Position played on team / speciality | midfielder |
Member of sports team | FC Midtjylland, Brentford F.C. |
Eye kolor | black |
Hair kolor | black hair |
Sport | association football |
Participant in | 2021 Africa Cup of Nations, 2023 Africa Cup of Nations |
Ogochukwu Frank Onyeka (MON dey bon am 1 January 1998) na Naija futbol playa wey dey play for FC Augsburg. Di klub de for Germany.
How e tek start life an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Onyeka for 1 January 1998 inside Benin Siti wey de Edo Stet in Naija. Na Onyeka bi di sekond pikin inside di five pikin-dem wey e peret bon. Onyeka tok sey e mama no wan mek e bikom futbola bikos e mama dey tink sey e fit no dey posibu.E mama wan mek e faze e buk for skul.
Wen Onyeka dey play for lokal klub Faith Motor Academy at di age of 15, Churchill Oliseh si am an like am as e dey play futbol dia. Churchill Oliseh bi di hona an manija of FC Ebedei ( di klub get koneshon wit Midtjylland klub wey de Denmark).
Na Churchill Oliseh mek Obafemi Martins dey popula . Bifor Onyeka start to dey play futbol for FC Ebedei, e dey helep e peret do som ru-fin wok. Onyeka nid to komot from Benin Siti go Sagamu wey de Ogun Stet to fit join FC Ebedei. E tok sey na dat time bi e fest time wey e wan komot from e vilej.
Onyeka no mind how di ples far rish an oda wahala wey e faze for dia as e don redi to faze enitin to fit bi a futbola.
How e tek play futbol
[chenj-am | chenj-am for orijin]Mitdtjylland Onyeka komot from FC Ebedei klub wey de Naija go Midtjylland in Denmark in January 2016. Onyeka play e fest game for di niu klub on 20 September 2017. Di game na bitwin e klub an Greve Fodbold for Danish kup. Onyeka goal de inside di 7:0 wey Midtjylland tek win dat day. Onyeka play e fest Supa-liga game for Midtjylland in di 2017-18 sisin on 9 February 2018. For dat game, Midtjylland bit AC Horsens 2:0 an Onyeka goal dey inside di two goal . Onyeka stil get goal for di 3:1 win wey e klub tek win FC Copenhagen on 18 February 2018. At dat time, na FC Copenhagen bi di lida for tebu for Supa-liga tebu.
Onyeka fest game inside UEFA Shampion Ligi na on 24 July 2018 wen Midtjylland play wit Astana FC.
- Brentford
On 20 July 2021, Onyeka sahin for Brentford klub. E fest game for Brentford hapun on 13 August 2021. For Brentford fest game of di sisin, Onyeka dey di tim wey bit Arsenal 2:0. Dat game na di fest game wey Brentford klub wan play inside premier Ligi for dia life.
Wen Onyeka dey Brentford, e no hesi for am to dey play evri tim for Brentford bikos of injuri wey e dey get. Dis one mek di manija to dey put am wen di game-dem wan dey finish. For 7 August 2023, Onyeka sahin anoda four years for Brentford. Onyeka fest goal for Brentford hapun on 13 April