Finidi George

From Wikipedia
Finidi George
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Famili nemGeorge Chenj-am
Wen dem bon am15 April 1971 Chenj-am
Ples wey dem bon amPort Harcourt Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitywing half Chenj-am
Wen e stat wok1989 Chenj-am
Eye kolordark brown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
LeaguePremier League Chenj-am

Finidi George (dey bon am 15 April 1971) na Naija profeshonal futbol kosh an a forma nashonal playa. Wen Finidi stil bi playa dat time, na right winga e bi. Finidi bi di kosh of Enyimba F.C. Enyimba F.C na one Naija Profeshonal Futbol Ligi. Wen Finidi don plai ball wel wel for Ajax- wey e tek win eight mejo taitu inkludin di 1995 Shapion ligi, e komot go anoda klub kol Real Betis. Finidi still plai ball smol for England bifor e kom finali ritaya. Finidi dey pat of di playa wey plai for Naija futbol tim an e plai in two Wold kup. Wen Finidi dey plai for Naija, e dey put on jersi nomba 7. Enyimba F.C tok for September 2021 sey Finidi go bi dia tim kosh. Finidi win e fest Naija Premiha Ligi at Onikan Stadiom in Legos on di 11 of June 2023.

Futbol klub wey e don plai for[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Ajax

Finidi wey dey bon for Pot Hakot plai futbol for three klub wen e de Netherlands. In 1993, Finidi with Nwankwo Kanu sahin for Ajax. Finidi put 4 goal for net as helep Ajax to win dia Eredivisie taitu for dat year an Ajax still win di taitu di folorin year. Ajax still plai two UEFA Shapion Ligi an dey win di 1994-95 tornamet. Ajax win A.C. Milan for di final dat year.

  • Real Betis

On di 10 July 1996, Finidi join Real Betis wey de Spain for 1, 024 million pesetas. For Real Betis , Finidi dey mek suo sey e dey score up to ten goal evri sisin. Finidi helep Real Betis finish for di nomba 4 posishon for ligi tebu for e fest year wen e kom di klub. For dat year wen Finidi kom di klub, e helep Real Betis enta final of Copa del Rey but F.C. Barcelona. (2-3 afta extra time]]. Na smol rimen Finidi foe go Real Madrid bifor e join Real Betis.

  • Mallorca an Ipswichs Town

Afta wey Real Betis don go religashon in 2000, Finidi stey for one year in spain as e join RCD Mallorca. Finidi leta join Premiha Ligi klub Ipswich Town wey di kosh bak den na George Burley for £3.1 million.

In November 2010, Finidi riton to Betis as dia daretor of intanashonal futbol.

How e tek plai for Naija[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na in 1991 Finidi fest plai futbol for Naija as Naija wan kwilifil for Afrika Kup of Neshon. Di futbol mach na bitwin Naija an Burkina Faso. Naija tim win Burkina Faso 7-1. Finidi put one goal for net an e hasist Rashidi Yekini to put three goal for Burkina Faso net. Finidi dey for di playa-dem wey win 1994 edishon of di tornamet.

Finidi don plai futbol in two FIFA Wold Kup, 1994 an 1998.

Kup an Awod-dem wey e don win[chenj-am | chenj-am for orijin]

Klub

  • Ajax
  • Eredivisie: 1993–94, 1994–95, 1995–96
  • Johan Cruijff Shield: 1994, 1995

UEFA Shapions Ligi: 1994–95; Runner-up 1995–96

  • UEFA Supa Kup: 1995
  • Intercontinental Kup: 1995

Betis

  • Copa del Rey runner-up: 1996–97

Intanashonal

  • For Naija
  • Afrika Kup of Neshon: 1994; Runner-up 2000; Third place 1992, 2002