FIFA World Cup

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

FIFA Wold kop wey pipul sabi as Wold kop na one intanashional futbol kompetishion wey sinior men Nashional tim memba wey dey onda FIFA dey plai.Na FIFA dey kontro enitin wey konsain Futbol.Na four four years dem dey plai di Wold kop sins dey stat di kompetishion in 1930.Di onli time wey dey no du di Wold kop na 1942 an 1945 bikos dat time Sekod Wold War happun for dat pirod.Di last kontri to win di Wold kop na France an na Russia kontri host di kompetishion in 2018. Bifor eni tim go fit plai for di tornamet, dey go fest kuolifae, an dis kuolifae games go happun bitwin di three years wey dey bifor anoda Wold kop go stat.Afta dat, dey go chuz di 32 tim wey go plai di tornamet for di kontri wey dey wan tek plai di game. Di kontri wey dey wan yuz for di tornamet go plai for di wold kop. Dey total final wey den don plai for wold kop rish 21 for 2018 FIFA Wold kop an di total nomba of kontri wey dey enta to plai for wold kop tornamet rish 79 in 2018 wold kop.Na 8 Nashional tim don win di tornamet. Brazil don win am for five times an na dem bi di onli Nashion wey don plai for all di times wey Wold kop don stat.Di oda Nashion wey don win di kop na Germany(4 time), Italy(4 time). Argentina (2 time) France(2 time), Uruguay(2 time). Spain(1 time) an Spain(1 time). Na wold kop bi di sport wen big pass an na e stil bi di sport wey pupil dey luk pass for T.V. Pipul wey luk 2006 Wold Kop go rush 26.29 billion an pipul wey luk di final of dat Wold Kop go rush 715.1 million. Na seventeen kontri don host di Wold kop an Brazil, France, Italy, Germany an Mexico don host am 2 time. Di kontri wey don host di wold kop one time bi: Uruguay, Switzerland, Sweden, Chile, England, Argentina, Spain, USA, Japan an South Korea join bodi host one, South Africa an Russia.Na Qatar dey host di 2022 Wold Kop an na Canada, USA an Mexico go join bodi host di 2026 Wold Kop.