Jump to content

Femi Hamzat

From Wikipedia
Femi Hamzat
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemFemi Chenj-am
Wen dem bon am19 September 1964 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, engineer Chenj-am
Post wey e deyDeputy Governor of Lagos State Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Ibadan Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am

Kadri Obafemi Hamzat (dem bon am on 19 September 1964) na Naija politishan wey sarf as deputy govnor for Legos Stet sins 2019.

Dem bon am insaid Legos insaid famili of Oba Mufutau Olatunji Hamzat wey don kpai an Alhaja Kehinde Hamzat (wey don kpai) fom Iga Egbe, Legos Stet. Im papa wey don kpai, Oba Mufutau Olatunji Hamzat, sarf as memba of di Legos Stet Hauz of Assembly an as komishona for Transporteshon insaid Legos (1979 - 1983) bifor e kon bi Vias Chairman of (South West) for bifor bifor Alliance of Democracy (AD). E leta bi Legos West Senatorial District Leader of di Action Congress an leta bi king bikos of wia e kom fom na king famili.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Hamzat on 19 September 1964 insaid Legos, Nigeria, Insaid di famili of Late. Alhaja Kehinde Hamzat wey kom fom Iga Egbe, Legos Stet.

E go Odu-Abore Memorial Primari Skul, Mushin, Legos Stet, Nigeria. E go Olivet Baptist High Skull, Oyo state, wey dey Southwest region of Nigeria for im sekondri skul. E finish fom Universiti of Ibadan in 1986 wit digre in Agricultural engineering in 1986 an masta in Agricultural Engineering insaid 1988. In 1992, e get PhD insaid PhD in System Process Engineering for Cranfield University, England.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

E wok for RTP Consulting Services, Columbia Universiti, Merrill Lynch Inc, Morgan Stanley an Oando Plc, wen e dey Oando, na im bi di Chief Information Offisa and Grup Head IT Strategist.

Awards[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dr. Hamzat won the fifth Lagos State Man of the Year Award in September 2013.[1][2]

  1. The Gazelle News "Works Commissioner, Femi Hamzat Wins Lagos Man Of The Year Award" Templet:Webarchive, The Gazelle News, Lagos, 29 May 2013. Retrieved on 28 November 2013.
  2. The Guardian Nigeria "Hamzat emerges 2013 Lagos Man of the Year" Templet:Webarchive, The Guardian Nigeria, Lagos, 8 September 2013. Retrieved on 28 November 2013