Femi Adesina

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Femi Adeshina na Naijá pesin wey bí jornalist an e dey serve as di Speshial Advaisa for Media and Publicity for Muhammadu Buhari wey bi di Presido of Naijá.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adesina go skul for Obafemi Awolowo University wey dey for Osun Stet an e stil go skul for Lagos Business School.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Femi Adesina stat to dey wok as pesin wey dey rait niuz for Radio Lagos bifor e kom go wok for Vanguard Niuzpepa. Adesina wok for Vanguard Nkuzpepa an National Concord Niuzpepa bifor e go wok for The Sun Niuzpepa. Na for The Sun Niuzpepa e bikom di oga wey oyinbo dey kol Ediitor-in-Chief.Adesina bi di presido of di Nigerian Board of Editors for one taim.E win di eleshion to bikom di Guild presido di sekod taim bot Adesina no finish di sekod taim bikos e get Govament wok.E stil komot fom e posishion Ediitor-in-Chief for The Sun bikos of di Govament wok.E stat wok as di Speshial Advaisa for Media and Publicity to Buhari on August 31, 2015.

Awod wey e don kolet[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nigeria Media Merit Qwards gif am awod as Editor of the Year for 2007.

Where we gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]