Ekiti State University

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Ekiti State University
university
Inception1982 Chenj-am
Official nameEkiti State University Chenj-am
Native labelEkiti State University Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityAdo Ekiti Chenj-am
Located in time zoneUTC+01:00 Chenj-am
LocationEkiti State Chenj-am
Coordinate location7°43′16″N 5°15′27″E Chenj-am
Memba ofAssociation of African Universities Chenj-am
Language of work or nameEnglish langwej Chenj-am
Language usedEnglish langwej Chenj-am
Official websitehttp://www.eksu.edu.ng/ Chenj-am
Map

Ekiti State University Ado Ekiti wey dey fom as Obafemi Awolowo University Ado-Ekiti in 1982 wen Shif Michael Adeknle Ajasin bi di fest sivilan govno of Ondo Stet.Di yunivasiti bi pat of Association of Commonwealth Universities.Pesin go si di skul afta pesin don drive 12 minit komot fom di sentra of Ado-Ekiti siti for Ekiti Stet in Naija. Ekiti State University Ado-Ekiti bi di onli yunivasiti in Naija wey don chenj nem four times for witdin 25 years wen dey kret am. Dey chenj di nem to "Ondo State University" in 1985, "University of Ado Ekiti" in September 2011.In 2021, Ekiti State University bi nomba 3 best yunivasiti in Naija akordin to webometrics.

Tori abaut di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kreashion For 14 January 1981, Shif Adekunle Ajasin wit di hep of di sivilian govament of Ondo Stet tok sey dey go like get molti-kampos yunivasiti for di Stet an dey arenj 16- memba kommittee for di projet. Na dis one mek dey fom di skul in March 1982 wit di nem Obafemi Awolowo University, Ado Ekiti an pik Prof I.O. Oladapo as di fest Vais- Shansellor an di fomin of di fest kausul wey Shif B.A Ajayi bi di Chairman on 28 March 1982. Na for one old fud rest house di skul tek stat in Akure an e kom move to tempoari site in Ado-Ekiti an na dia klass stat with 136 studet wey dey three falkoti wey bi Falkoti of Aarts, Science an Social Science. For di 1983/1984 kalenda, dey add som korse like Geology, Biology, Chemistry, French, Yoruba Studies, Philosophy, Religion Studies, Political Studies an Psychology. In 1983/84 kalenda, dey add di Falkoti of Education an dis inkris di studet nomba to 724.In 1985/86 kalenda, dey add falkoti of Engineering ( Civil, Mechanical an Electrical) an Dipatment of Banking and Finance. Di falkoti of law na im dey add for 1991/92 kalenda an in 2001 dey add falkoti of Agrikolshoral Science mekin all di studet nomba bi 10,000 in 8 falkoti.For now, na ova 25,000 studet dey di skul.

Pipul-dem qwy dey run di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di folorin pupil bi di ogas for di yunivasiti:

  • Visitor

Biodun Oyebanji, ezekutive Govno, Ekiti State of Nigeria.

  • Shansellor

HRH Alhaji Lamidi Sanusi, forma Emir of Kano

  • Pro-Shansellor an Shihaman of Kansu

Prof. Bamitale Omole

  • Vais-Shansellor

Prof Edward Olanipekun

Falkoti an Kolej wey dey di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Agricultural Science
  • Arts
  • Basic Medical Sciences
  • Clinical Sciences
  • Education
  • Engineering
  • Law
  • Management
  • Science
  • Social Science

Popula pupil wey konot don di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]