Jump to content

Ebele Okaro

From Wikipedia
Ebele Okaro
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemEbele Chenj-am
Famili nemOkaroh Chenj-am
Wen dem bon am19 January 1964 Chenj-am
Ples wey dem bon amLondon Chenj-am
Broda an sista4 Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Calabar Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Awod wey e koletAfrica Magic Viewers' Choice Awards, Best of Nollywood Awards Chenj-am
Nominated forAfrica Magic Viewers' Choice Awards Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Ebele Okaro Onyiuke (dem bon am for January 19, 1964) na Naijá Aktres and fim produsa.

How e tek stat life an skul wey e go

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na January 19, 1964 dem bon Ebele Okaro for London bot na Enugu stet in Naijá. Na fom pamari skul in Santa Maria Primary School Okaro don stat dey akt. Okaro go Nsukka's Queen of Holy Rosemary Secondary School.Leta e go rid Education for University of Calabar wey dey Kross Riva bot chenj to Dramatic Arts. Okaro kom get Bsc for Theatre Arts. Okaro mama na television produsa an e papa na engineer wey luv Arts and Literature.

How e tek stat wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Okaro finish univasiti, Okaro saf e papa land ( youth koppa) or e du National Youth Service for Nigeria Television Authority (NTA) wey e sho for som program.Wen e du youth koppa finish, e wok for embassi for Legos an leta e wok for Bank bifor e kom stat to dey akt for Naijá fim.For 2014, Okaro produs an akt for di fine Musical Whispers.Di fim tok abaut how to tekia of pikin wey dia brain no dey wok as norma pipul (Autism).Aktor an aktress wey akt for di fim bi Chioma Chukwuka an Kalu lkeagwu.Okaro dey popula sotey pipul dey kol am mama of Nollywood an e don win di respet of bot fanz an e oda aktist-dem.

E pasonal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na fom di famili of Oyiuke e tek pik hosband.

Awods an Nominashon

[chenj-am | chenj-am for orijin]
Caption text
YearAwodKatigoriFimResotRef
2019Africa Magic Viewers Choice AwardBest Soportin Aktress4-1 lovewin
2019Africa Magic Viewers Choice AwardBest Aktress in a comedy(movie/TV series)SmashNominated
2019Best of Nollywood AwardsBest Soportin Aktress English RolBlackrosewin