Dora Akunyili

From Wikipedia
DoraAkunyili

Dora Nkem Akunyili (dey bon am 14 July 1954 an e kpai bi forma Daretor- Jeneral of NAFDAC ( Nashonal Agensi for Fud an Drug Hadiministrashon an Kontro) of Naija from 2001 to 2008.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Makurdi in Benue Stet wey de Naija dey bon Dora. E papa nem na Paul Young Edemobi an na for Nanka from Anambra Stet e kom from. Dora go Patrick's Pamari Skul, in Isuofia wey de Anambra Stet. E finish pamari skul in 1966. Dora finish Kween of di Rosary Sekondri Skul Nsukka, Enugu Stet in 1973. Na beta risot Dora tek finish e sekondri skul an dis one mek am fit win Easta Nigerian Govamet Post Pamari skolaship an di Fediral Govamet of Naija Ondagraduate Skolaship.

Dora go rid Famakoloji for Yunivasiti of Nigeria an na 1978 e finish di Yunivasiti. In 1985, e risiv e Ph.D satifiket in Ethnopharmacology from Yunivasiti of Nigeria.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dora don wok for plenti Stet Govamet komiti wel wel. E don bi Supavasor advaisa for Agrikolshor for lokal govamet unit in Anambra Stet.

Dora don wok for Yunivasiti of Nigeria Tishin Hospitu (U.N.T.H), Enough Stet as Famasis. In 1981, Dora bi di Graduate Hasistat for Falkoti of Famasetikal Sayensi in UNN. Dora bikom Sinior Leshura in 1990 an in 1996, e bi di Famacologist Konsotant at di Kolej of Medisin.

In 1996, Dora bikom di Zonal Seketiri of di Petrolium Spesha Trust Fund (P.T.F). E wok na to supavas projet wey orye kompini dey do in Naija Souta-Easta Stet. Forma Presidor, Olusegun Obasanjo pik am mek e bi Daretor-Jeneral of NAFDAC (Nashonal Agensi for Fud an Drug Hadiministrashon an Kontrol in 2001. Dora wok as Daretor-Jeneral of NAFDAC from 2001 go rish 2009.

How e tek join politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fedir Govamet pik Dora to bi Minista of Informashon an Kominikeshon in 2008. Dora risain komot for di posishon on December 16, 2010. Di risin Dora komot na bikos e wan go for sinetor for Anabra Senta in Nashonal Hasembli.

In April 2011, Chris Ngige win am for di posishon of Sinetor wey go kom from Anambra Senta. Chris Ngige yuz ACN parti win Dora APGA parti for di eleshon. Dora kompleni sey ojoro de di eleshon wey .ek Chris Ngige win to Indipendet Nashonal Eletoral Kommishon (INEC).

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dora hosband na Chike Akunyili. Chike Akunyili na medika doktor an di marej produs six pikin-dem: Ijeoma, Edozie, Somto, Njideka, Chidiogo, an Obumneme. In 2017, one of e pikin, Njideka Akunyili Crosby win John D. and Catherine T.MacArthur Foundation.

Na for 2012 Dora rait an poblish e buk wey di nem na The War Against Counterfeit Medicine: My Story. Dora Akunyili kpai for one hospitu wey de India on 7 June 2014 afta two years wey e don dey trit Uterine kansa. Dem beri am on 27 an 28 August 2014 an plenti big pipo for Naija kom e beriha serimoni. Na Agulu in Anambra Stet wey bi e vilej dey beri am.

Awod wey e don kolet[chenj-am | chenj-am for orijin]

No Naija pesin don kolet awod rish Dora Akunyili. Di awod wey Dora don kolet pass 900. Some of di awod na were:

  • Order of the Federal Republic, OFR
  • Time magazine award 2006 ("One of the eighteen heroes of our time")
  • Person of the Year 2005 Award – Silverbird Communications Ltd, Lagos, 5 January 2006
  • Award of Excellence – Integrated World Services (IWS), December 2005
  • Award of Excellence – Advocacy for Democracy *Dividends International, Lagos, 17 December 2005
  • Meritorious Award 2005 – St. Michael's Military Catholic Church, Apapa, Lagos, 4 December 2005
  • African Virtuous and Entrepreneurial Women Merit Award 2005 – African Biographical Network, December, 2005
  • Award for the Best Government Parastatal – National Association of Nigerian Students (NANS), December, 2005
  • An Icon of Excellence Award – The African Cultural Institute and Zenith Bank PLC, 8 December 2005
  • 2005 Grassroots Human Rights Campaigner Award London-based Human Rights Defense Organization, 8 December. 2005[40]
  • Most Innovative Director Award Federal Government College, Ijanikin, Lagos, October, 2005
  • Integrity Award 2003 – Transparency International