Beautiful Nubia

From Wikipedia
Beautiful Nubia
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1968 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Ibadan Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Official websitehttp://www.beautifulnubia.com/ Chenj-am

Beaitiful Nubia na im stej nem bi dat an im ril nem na Segun Akinlolu (bon 11 Novemba 1968) na Naija pesin wey sabi rait song wey olso sabi kompos song an na band lida.

Beautiful Nubia an di Root Renaissance band na Naija Trandishonal root muzik grup. Na Segun Akinlolu (aka Beautiful Nubia) organize di grup an na im stil bi di lida of di grup. Bikos of dia song pipul don sabi dia grup wel wel.for Naija an oda ples in d world. Segun Akinlolu na advoket for soshia reform an e don du dis wit im trandishonal song. "E don put all im life to dey endure biliv fo power of chenj; dat our society no dey irredeemable an sey evritin fit stil bi koret"

Theme[chenj-am | chenj-am for orijin]

Most of Beautiful Nubia song na trandishonal an nativ sweet song wey dey pas mesej wey go mek pipul value life, respect nashor an go mek u Sabi how to dey liv wit pipul wey fight no go dey. Im dey olso prish sey eveybodi dey equal an get sem right. Im muzik also dey prish abaut love an endurance an olso tel pipul to Sabi to dey defend anstand for dia right if enibodi wan to dey cheat dem. Im songs transcend parochialism wen Dem go for appeal for African sensibilities an get univasa truth.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Segun for Ibadan in 1968, an e stat to dey rait song wen e dey very smol. Na for smol e don dey du im traditional song wey dey in fom of oral poetry, tiata, muzik an tradishonal song. For 1997 e Kom out wit EniObanke a muzik prodoshon an maketin Kompani na onda dis rekod lebel im rilis im fess abom for1997. Na onda dis rekod lebel e don dey du all of im abom. For 2010 di kompini stat im fess ever tradishonal an root song in Naija di one wey dem dey du every year wey dem dey kol EniObanke Muzik Festival(EMUfest) in 1998 di kol all new artis meni yong muzishan wey dey Lagos State wey go dey follo am sing as bak up singa wey im giv di nem di Root Renaissance Band.