Jump to content

Ayinde Barrister

From Wikipedia
Ayinde Barrister
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am9 February 1948 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Wen e kpai16 December 2010 Chenj-am
Place of deathLondon Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusician, military personnel Chenj-am
Wen e stat wok1965 Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Stai of song abi fimfuji music Chenj-am

Sikiru Olalade Ayinde Balogun MFR (dem bon am on 9 February 1948 - 16 December 2010) wey plenti pipu sabi as Ayinde Barrister na Naija bon Yoruba singa-songraita, songprodusa an Muzik parforma. E dey insaid singa wey stat Fuji an Wéré muzik. Afta dem fest sabi am for im wok in 1965, Ayinde Barrister don rilis ova 70 studio album.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ayinde Barrister wey dem bon on 9 February 1948, to di famili of Salawu Balogun wey dey sel tins for Ibadan, an im papa dey sel meat.

Edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

E stat edukashon for Muslim Mission Skul an di Model Skul, Mushin, Legos. E stodi type raiting at Yaba Polytechnic.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ayinde Barrister stat to dey sing wen e dey smol as ajiwere singa for Ramadan taim.

E wok as typist, wey dem sabi nau as Secretary, for Nigerian Breweries an leta go Nigeria Army as clerk for Nigerian Civil War taim. E sarf as 10th Brigade of di 2nd Division of Nigerian Army onda Col Adeniran an faight in Akwa, Abagana an Onitsha. Wen e kom bak fom di war, dem kon post am go Army Signals Headquarters, Apapa an leta go Army Resettlement Centre, Oshodi. E komot for army to fes muzik.