Jump to content

Amina Titi Atiku Abubakar

From Wikipedia
Amina Titi Atiku Abubakar
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAmina Titilayo Atiku-Abubakar Chenj-am
Wen dem bon am6 June 1949 Chenj-am
Ples wey dem bon amOsun State Chenj-am
Pesin wey e mariAtiku Abubakar Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactivist, politician Chenj-am
Wie e go skulKaduna Polytechnic Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Amina Titilayo Atiku-Abubakar (dem bon am as Titilayo Albert; bon am on 6 June 1951) na Naija pesin wey lik to dey faight for wuman raight an pikin raight an na stil bi di forma waif of bifor bifor Naija vais president of di Fediral Repoblik of Nigeria, Atiku Abubakar. Na shi stat Woman Trafficking and Child Labour Eradication Foundation (WOTCLEF) an na shi stat bill wey mek dem du Nashonal Agenci for di Prohibition of Trafficking in Pesin (NAPTIP).

How shi tek stat life an edukashon

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Titilayo Albert insaid Christian famili of Albert, Yoruba famili fom Ilesa, Osun Stet. Shi gro insaid Legos for Lafiaji, Legos, e go St. Mary's Iwo, Osun Stet for sekondri edukashon.

Insaid 1971, shi mari Atiku Abubakar, wey bi custom ofisa dat taim, bifor shi go Kaduna Polythenic. Shi sabi spik Yoruba an Hausa langwej wel wel. Shi chenj fom Christian to Islam.

Shi don wok for Kaduna Stet Polythenic. Shi go Rome to go stodi in 1986 an 1987, shi dey holways ci Naija girls for road. Shi leta kon sabi sey plenti girls dey du Ashewo wok for dia oga, an dem no dey pay dem.

WOTCLEF & NAPTIP

[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1999, wen im hosband, Atiku Abubakar, bi vais president, shi stat to dey du tins to stop pipu wey dey du Ashewo wok an how dem dey kari smol smol girls go du wok. Shi stat Women Trafficking and Child Labour Eradication Foundation (WOTCLEF), shi kon stil mek dem du lor to ponish pipu wey dey kari smol girls du Ashewo an som bad wok, na dat wan mek govmet stat Nashonal Agency for Prohibition of Trafficking in Pesin.

  • Annual Nigerian Women's Award (2002)[1]
  • D'linga Award (2010)[2]


Na Aminu Titi Abubakar rait buk lik:[3]

  • Educating the Nigerian Child[4]
  • Empower Law to Fight Child Slavery[5]
  • Let Us Celebrate Humanity: A collected speeches on women's right and human trafficking[6]

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. "Nigeria: Titi Atiku, 16 Others Bag Women Awards". This Day (Lagos). All Africa. 29 May 2002. Retrieved 16 June 2017.
  2. Ojoma, Akor (28 June 2010). "Nigeria: Titi Atiku, Osaze, 73 Others Win d'Linga Award". Daily Trust (Abuja). All Africa. Retrieved 16 June 2017.
  3. "Educating the Nigerian Child". www.africanbookscollective.com. African Book Collective. Retrieved 16 June 2017.
  4. Atiku-Abubakar, Amina Titi; Chirwa, Chris (December 2005). Educating the Nigerian Child (in Ínglish) (Paperback ed.). Nigeria: Spectrum Books. ISBN 9789780294229.
  5. Atiku Abubakar, Amina Titi (2001). Empower law to fight child slavery (in English). Nigeria: WOTCLEF. OCLC 810891038.{{cite book}}: CS1 maint: unrecognized language (link)
  6. Atiku Abubakar, Amina Titi; Fagbohungbe, Tunde; Fabiyi, Sayo (16 June 2017). Let us celebrate humanity: a collected speeches on women's right and human trafficking, volume II (in English). WOTCLEF. OCLC 810886562.{{cite book}}: CS1 maint: unrecognized language (link)