Alimosho

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Alimosho na one lokal govamet inside lkeja wey dey inside Lagos State for Naija. Na di lokal govamet big pass for all di lokal govamet wey dey for Legos Stet. Alimosho get 1,288,714 pipo. Na as dem kaunt evribodi wey dey inside Naija for 2006 dem tok dis one ( Legos Stet govamet sey na big lie bí dat ooo!dem sey di pipo plenti pass like dat, dem say di nomba of pipo wey dey live for Alimosho lokal govamet pass 2 million). Alimosho lokal govamet don brake to smol smol into Lokal Komuniti Divelopmet Aria (LCDA). Dis LCDA start to dey wok afta Mr Bola Ilori finish to dey in kontro of di old single Alimosho lokal govamet. Alimosho skata into six smol- smol lokal Komuniti Divelopmet Aria wey dia names na:

  • Agbado/Oke-odo,
  • LCDA Ayobo/lpaja,
  • LCDA Alimosho LG,
  • Egbe/ldiemu LCDA,
  • Ikotun/Igando LCDA,
  • Mosan Okunola LCDA.

Alimosho aria wey mek sense pass na Egbeda/Akowanjo. Na for 1945 dem born Alimosho and dat time e dey onda westa rijion.

Na Egbado pipo plenti pass for Alimosho. Di pipo-dem gudfor dia kolsho wel wel. Dem get oro , lgunnu and Egungun festival wey dem dey do evri year. Dem get two rilijon wey dem tek no dem; na moslim an Kristen. Di lanwej wey dem sabi pass na Yoruba. Di fest govamet house for Alimosho na two Tori buildin wey dey for kansu street, now na Egbe/ldimu LCDA.