Adunni Ade

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Adunni Ade
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Industryfilm industry Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija, Amerika Chenj-am
Nem for lokal langwejAdunni Ade Chenj-am
Orijina nemAdunni Ade Chenj-am
Fest nemAdunni Chenj-am
Famili nemAdewale Chenj-am
Wen dem bon am7 June 1976 Chenj-am
Ples wey dem bon amQueens Chenj-am
Pesin wey e mariunmarried mother Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dufilm actor, model, actor Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Kentucky Chenj-am
Academic degreeBachelor of Accountancy Chenj-am
Wen e stat wok2006 Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Notable workSoólè, The Vendor, Diary of a Lagos Girl, Ratnik Chenj-am
Awod wey e koletunknown value Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Adunni Ade (dem bon am for June 7, 1982) na Amerika/Naija aktres an model.

How e stat life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Queens, New York, United Stet dem tek bon Adunni Ade to German-Irish moda an Yoruba Naija fada. Adunni Ade bi Nollywood aktress and fashion model. E kom Naija wen e bi two years wit e perent to dey e grand fada beria.Adunni Ade grow for Legos Stet, Naija til e almost rish 20 years bifor e go bak to United State so dat e go fit go yunivasiti. Adunni Ade go Chrisland primary School.E go Bells Comprehensive Secondary School Ota, Ogun Stet for e sekondiri skul.Im papa wey bi Legos-bes , an soseful bizinessman na im go rid akounting. Adunni Ade get im digri for akounting for Univasiti of Kentucky for 2008. Bifor e kom bak to Naija, Adunni Ade Don wok wit di Stet of Kentucky for Housing sector wey dey gif living assistance an also State of Maryland Medical Insurance Department wey dey gif medikal insurance (Medicare and Medicaid) to pipul wey nid am.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adunni Ade don wok for Housing and Insurance sectors for United States bifor e chenj to entatement indostrie.Adunni enta fashion modelling an sho for America's Next Top Model. Afta Adunni go bak to Naija, e fest Nollywood rol wey e akt na one yoruba langwej fim wey get di nem You or I for 2013.E pass 170,000 wey luk di smol vidio komedi skesh “Date Gone Bad” wey Adunni rilis for YouTube for 2014.Adunni don akt inside meni oda Nollywood fim both for Inglish an Yoruba langwej, inkludin som muzik vidio for Sound Sultan an Ice Prince.E risif Stella Awod fom di Nigerian Institute of Journalism for di wok e dey du to promot Nigerian Kolshor. For 2017, Adunni Ade bikom di brand ambassador for OUD Majestic. For 2018, Adunni rait an produs e fest yoruba fim: "Emi Mi - My Soul", na Saheed Balogun bi di dareto. Pipul wey dey di fim na Ibrahim Chatta, D'Marion Young, Sunkanmi Omobolanle, an Shola Kosoko . Leta dat year, e produs anoda Yoruba drama fim: "Ewa - Beauty", na Saheed Balogun bi di dareto an pipul wey akt inside di fim na Ibrahim Chatta, Yinka Quadri, Kunle Omisore, an Tayo Sobola. Adunni don akt insaid more dan 100 Fim for Naija (bot for Inglish an Yoruba pat of Nollywood).

E pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adunni get two son D'Marion an Ayden. E opun up sey e go dey tek kia of di pikin dem afta di marej skata.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]