Adegoke Adelabu

From Wikipedia
Adegoke Adelabu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am3 September 1915 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Wen e kpai20 March 1958, 25 March 1958 Chenj-am
Cause of deathtraffic collision Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, merchant, raita, journalist Chenj-am
Wie e go skulGovernment College, Ibadan Chenj-am
Party wey e dey for politisIbadan Peoples Party Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am

Gbadamosi Adegoke Adelabu (dem bon am for September 3, 1915 an e kpai for March 25, 1958) na Naija politishian wey kom fom Ibadan an put hand for Ibadan Politis bifor Naija get fredom (Indipendense) fom Inglish pipul in 1960.Ibadan na one big siti for Westan rijion of Naija. From 1955 go rish 1956, na Adegoke bi di oga kpata-kpata for Natural Resources and Social Services.E stil bi di oga for di pipul wey no dey sopot Western Regional Assembly ontil e dai for 1958.Adegoke famili no too get moni.Na Adegoke wok by imsef to get moni an bikom big pesin for Naijs politis mata. Na Gofment Kolej for Ibadan e tek go skul an e kom bi big biznesman.Adegoke for mek am big for politis mata if no bi sey e dai for moto asident an e no too tey wey Naija get indipendense bifo e dai so. Adegoke Adelabu na pesin wey rili biliv sey mek we dey du di tins wey go fevo Naija an mek Naija kontrol evritin wey we dey mek for insaid di kontri.

How e tek stat im laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na 1915 dem bon Adegoke an na Sanusi Ashinyanbi an Awujola Adelabu bi im papa an mama. Na im mama bi di sekond waif an im mama dai wen Adelabu stil bi smol pikin. Na im papa sista kom leta tek kia of am. E skul for St David's C.M.S. School, Kudeti, Ibadan fom 1925 go rish 1929. Adegoke kom finish standard IV an V for C.M.S Central school, Mapo. Opon sey im papa sista na muslim, shi stil mek Adelabu go skul wey Kristen missionari dey kontrol an e kom get satifiket for pesin wet don baptais. Dis one kom mek Adelabu fit go oda skul wey CMS dey kontrol. E stat im sekondri skul for 1931 an im finish for 1936 as di hed boi. E rait im ezam to enta skul an e pas wel wel so tey UAC kom pay for im skul moni an buk for am to go rid Commerce for Yaba Higher College. Bot im no yuz di moni wey UAC pai for am for skul finish, na just 6 months e don yuz for di big skul for Yaba bifo e kom bigin wok for UAC as di sekond oga for Ibadan district.Adelabu oga na one oyinbo man wey e don fest mit di year bifo im enta skul for Yaba. Di fest tin wet dem tel am to du na to waka raund evri ples wey dem dey du di Kokakola drink for Ibadan. Afta im don waka finish, e kom bring plan for how dem go tek stat to dey kari di miniral go difren difren ples an how dem go tek sel am. Dis one kom mek dem giv am big posishion for UAC as di sekond oga for di Prodokshion Manija. Bot im no wok dia for long bikos na for 1937 e komot for dia an join di biznes wey pipul dey du to bai an sel tins. Dis biznes no fevo am at all an bifo im sabi wetin dey hapun, e don bigin faind gocment wok. For 1939, e kom dey wok as pesin wey dey chuk eye for pipul wey dey plant difren difren fud an wey dey tish animal-dem to mek suo sey dem dey du am wel. Afta dis one, e kom stil wok as pesin wey dey chek wetin pipul dey du for one smol join-bodi grup wey pipul inside dey hep diasef an na Akinpelu Obisesan bi di oga kpata-kpata for di grup. Adelabu dey for dis grup ontil 1945 wen e kom go bak to UAC. Dis time araund di work gud for am wel wel bot im liv di wok afta di pesin wey tish am di wok, wey e nem na Richardson, stop di wok sef. E kom put di plenti moni wey e mek fom UAC insaid klot biznes wit Levantine kompini for Ibadan. Bot Adegoke kom see sey di pipul wey dey rul for Ibadan wey dem dey kol Mogaji an Olubadan no go skul an dem no sabi rid an rait, so e kom mit dem an bigin wok for dem as di pesin wey go dey rid an rait evritin wey dem dey du for di ples wey dem dey fom rul an joj di Ibadan pipul.

How e du for politis mata[chenj-am | chenj-am for orijin]

1949–1953

Adegoke wok for politis stat wen e join som smol shif-dem mek dem join-bodi to komplen abaut Salami Agbaje. Plenti pipul sabi Adegoke as pesin wey sabi do tins kwik-kwik an bikos of sey e sabi rid an rait, di pipul wey dey rul dat taim nid am to tek fait Agbaje. Dem nid pesin wey go fit dey hep dem rait wetin dem nid to tek rait abaut wai dem no laik Agbaje an na Adegoke dem see as wu go hep dem. Adegoke gri sey e go bi di pesin wey go dey hep dem to dey rid an rait as dem dey fait Salami Agbaje wey dey du biznes an e get moni wel wel an e stil go skul an sabi rid an rait, an na im bi di nomba 3 pesin wey nia di king pas. Dis oda shif-dem wey dey fait am, no laik di way im dey do tins an plenti of dem dey own am moni. Di smol smol shif-dem an Mogaji-dem no wan mek Agbaje bi di Olubadan na im mek dem dey du evritin for dia pawa to fait am. Adegoke rili put bodi for di wok an e rili rait evritin wey di shif-dem nid to tek ripot Agbaje to di oyinbo pipul wey dey rul for dat taim. As dis tin-dem dey hapun, na Adegoke bi di pesin wey dey rait an rid for di Egbe Omo Ibile wey bi di main grup wey wan komot Agbaje. Na Bello Abasi bi di oga kpata-kpata for dis grup an na e papa wey e nem na Aleshinloye bi di foma Olubadan. As di mata kom rish di oyinbo pipul, dem kom tel Agbaje to komot bodi for di pipul wey dey rul for Ibadan dat taim. Bot dem kom stil yuz dis one chenj som kain tins for di ples wey dem tek dey rul. For ezampul, dem komot one grup wey di nem na Oshun division from di Ibadan area, dis one rili ves som of di Ibadan pipul an e kom mek som pipul join bodi for smol smol grup to join evribodi togeda so dat e go swit di Ibadan pipul.

Wen di taim rish for di pipul for Ibadan to selet wu an wu dem wan mek e dey lid dem for 1951, di grup wey Adegoke dey wey di nem na Egbe Omo Ibile join bodi wit one man wey e nem na Augustus Akinloye an som oda yong boi-dem an yong gel-dem wey dey anoda grup wey dia foma nem na Ibadan Progressive Union kom stat anoda smol grup wey e nem na Ibadan People's Party. Dem du dis one to yuz fait di Ibadan Progressive Union. Adegoke rili put bodi for dis one to fait di pipul wey no laik di Ijebu pat for Ibadan, espeshali as dem don fest komot Oshun division wey dem di oga for Action Congress laik Awolowo wey bi Ijebu man dey sopot an anoda man wey e nem na Akintola. Dis niu pati win all di 6 sit go rich di Western Regional Assembly. Bot Adegoke kom tok sey e go laik mek dem du one smol grup wey go dey sopot NCNC bot di grup skata an 4 pipul fom dis grup go join AG. Adegoke kom rili put bodi wel wel for insaid NCNC for Ibadan, e kom bi di pesin wey dey hep di Western Province Working Committee dey rid an rait for evritin wey dem dey tok for dia mitin. Pipul Kom bigin sabi am as di onli pesin wey dey joj mata for insaid kot for IPP wey kom stil dey wit NCNC. Bifo wi no wetin, pipul don bigin to sabi Adegoke for evriwia for Naijá so tey for 1952 e kom rait one buk wey e nem na Africa in Ebullition. E yuz dis buk tek tok evritin wey dey e mind abaut politis mata. E wan kom stil fom anoda grup wey go rili dey fait di pipul for AG for di taim wey pipul wan selet di pesin wey go dey lid dem for 1954. E kom stil fom anoda one wey dem dey kol Taxpayers Association so dat plenti pipul go laik am bikos of di way im tek arenj di tax mata. Dis grup kom stil join bodi wit som pipul wey dey do fam wok wey dia nem na Maiyegun. Dem fom di grup wey dem dey kol Mabolaje Grand Alliance.

1954–1958

Adelabu an e grup kom rili bi problem for di pipul wey dey di grup wey IPU an AG dey kontrol. E rili wahala dem wit di way im tek arenj di tax mata an di wok of di pipul wey dia famili dey rul (Mogajis) for gofment mata. E kom put imsef as pesin wey dey sopot di way dem dey rul dem an di tins bifo dem di oyinbo pipul kom tish dem dis niu sistem. Wen di taim rish for di pipul to selet wu di popul wey go lid dem for 1954, Adegoke kom win plenti of di posishon for di Ibadan District Council. Dis one kom mek Adegoke bi di oga kpata-kpata for dat aria. Im kon be di oga kpata-kpata for pipul wey dey kontrol moni an evri smol smol grup for dia. Wen di taim rish for pipul to chuz di pesin wey go dey rul dem for Naija for 1954, Adegoke kom win one posishon for House of Representatives an im grup sef dem win plenti-plenti post for di House of Representatives. E kom get one taim wey e kom bi di sekond oga for NCNC for Naija, dem kom stil mek am di oga kpata-kpata of pipul wey go dey giv Naija pipul all di beta-beta tin wey dem nid. E du dis one join di one wey e fest bi as di oga kpata-kpata for di Ibadan District Council fom January 1955 go rish January 1956.

For 1955, dem kom bigin chuk eye insaid di way Adegoke an im pipul tek dey do moni mata, to see weyda dem dey chop di moni wey dem sopos yuz for di Naija pipul. Na di oga dem for Western Region Government du dis one an na AG kontrol am. Dis one kom mek Adelabu tok sey im no wan du di wok of pesin wey dey kontrol som pipul again. Na one man wey e nem na J.M. Johnson kom stat to dey du di wok as di oga kpata-kpata of di pipul wey go dey mek sure sey Naija pipul get beta beta tins. For 1956, Adelabu kom stil trai to mek di pipul chuz am as di oga kpata-kpata for NCNC for Western Region. Im biliv sey e go win, na so e kom go bai plenti klot kom rait "Adelabu, Premier of the Western Region"on top, bot im an im grup stil no win. Na Action Group win am. E kom bi di oga kpata-kpata for one grup wey dey allways tok sey dem no laik di way Western House of Assembly tek dey du tins. Afta e lus dis niu post, e kom trai to mek suo sey dem fom niu Stet komot from Western Region. Dis niu Stet sopos bi for di pipul wey rili get maut for di NCNC an dem bi Oyo, Ibadan an Ondo side. Bot dem no sopot dis e idea for 1958 bikos dem see am sey im du am base on na wi-wi mata. For stil dat 1958, Adegoke stat to dey tok sey e no laik di way Azikiwe tek dey rul bikos di tin na 3-in-1 mata wey bi sey na AG, NCNC and NPC dey insaid. E rili pain am sey AG folo for di mata. E tok sey dat kind tin no pure at all.

How im tek kpai[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adegoke Adelabu dai for Mile 51 for Lagos-Ibadan Expressway for Shagamu said. Na im wit one man wey kom from Syria dai.Di man sabi how to dey bai and sel tins. Dia moto nak anoda moto as dem dey kom bak fom Lagos.

Pekulia mes[chenj-am | chenj-am for orijin]

Plenti pipul wey dey tok abaut wetin don hapun bifo nau for Yoruba an Naija dey allwes tok abaut di pesin wey stat dis tok wey dem dey kol "penkelemesi". Dis tin na di Yoruba way to tek tok "peculiar mess". Adegoke na pesin wey evribodi sabi sey e sabi spik Inglish wel wel. One day wey im dey tel pipul abaut di way tins bi for Western Region House of Assembly, som pipul wey no sabi English Kom bigin tok sey Adelabu say "penkelemesi".

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]