Abass Akande Obesere

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Abass Akande Obesere
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAbass Chenj-am
Wen dem bon am1965 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusician Chenj-am
Wen e stat wok1981 Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Stai of song abi fimfuji music Chenj-am

Abass Akande Obesere (dem bon am for January 20, 1965) wey pipul dey kol "Omo Rapala" na Naija Muzishan, singa an rekod produsa wey kom fom Ibadan, wey bi big ples for Naija. Obesere na pesin wey pipul no wel wel for im wok wey bi to dey sing fuji song. Meni pipul laik im wok bikos di kain mentod wey e dey yuz arenj im song dey mek pipul for maket, strit, vilej an garaj laik dem. E dey folo di Sikiru Ayinde Barrister ezampul wey pipul sabi wel wel for Naijá an for di wold, Obesere don kari im muzik go difren difren kontri sef. Sony Music giv am kontrat bot im komot wen dey no gree ontop moni mata, Obesere kon go du kontrat for anoda ples, Obesere an K1 D ultimate wey dey sing fuji muzik sef no dey gree for diasef.

Na Mayor Ville Entertainment wey dey sign pipul wey dey sing na dem Obesere sign kontrat for now. Mayor Ville Entertainment dey onda Maxoglan Entertainment wey dey Lagos for Naijà.

Alhaji Obesere moto wey bi Lexus jeep Lx470 get asident for Ijebu wen im dey kom Lagos. Di asident hapun for Sunday April 8 2012, di taim wey di tin hapun na 7:30pm. Pipul wey dey tok niuz tok sey Obesere an two oda pesin dey for di moto wen di tin hapun an no bi sey dem dai as dey kari dem go hospitu for Orisunbare Hospital, Jakande Isolo, Lagos. Na wund di two pesin get for di moto.

Some of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Introduction
  • Oodua
  • Diplomacy
  • Elegance
  • Live in Europe
  • Asakasa (Sony).
  • O .B.T.K (Sony)
  • Mr Teacher
  • Omo Rapala Overthrow. (Dudu Heritage)
  • American Faaji Series 1&2 (Dudu Heritage)
  • His Excellency (Bayowa)
  • Egungun be Careful (Bayowa)
  • Old skool lapel.(Bayowa)
  • Apple.Juice (Bayowa)
  • Okokoriko (Bayowa)
  • Obaadan (Bayowa)
  • Efissy (Coperate Pictures)
  • Confirmation (Coperate Pictures)

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]