Wofai Samuel

From Wikipedia
Wofai Samuel
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Famili nemSamuel Chenj-am
Wen dem bon am18 September 1990 Chenj-am
Ples wey dem bon amNaija Chenj-am
Wok wey e dey dujournalist Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Calabar, Federal Government Girls College, Calabar Chenj-am
Wen e stat wok2007 Chenj-am

Wofai Samuel (dey bon am 18 September 1990) na Naija pesin wey de tok for redio, T.V, an Niuz-pepa.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Calabar, wey de Kross Riva Stet dey tek bon Wofai Samuel. Samuel go Fediral Govamet Girls Kolej . E kom go Yunivasiti of Kalaba to go rid Zooloji an Envaromenta Sayensi. Yunivasiti of Kalaba give Samuel e Bashelor of Sayensi Digri (B.Sc) in 2012 wen e finish di korse. Samuel kom go kolet diploma in Human Risosis Manijimet an Organaseshon Divelopmet from Yunivasiti of Legos, wey de Naija.

How e tek work[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Samuel bi di Aktin Daretor-Jenera of di Naija-Amerika Shamba of Komans. E join di Shamba of Komans as dia Daretor of Komunikeshon , Govamet Releshon an Advokesi. Dis one mins sey na Samuel dey tok wetin dey hapun inside di organaseshon to Poblik an e dey repriset dem for enitin wey go join dem with Govamet. Bifor Samuel join Naija-Amerika Shamba of Komans, e don work as Daretor of Komunikeshon an Estanal Afihas to di UK-Liberia Shamba of Komans divishons (Affliates).

For 2020, na Samuel bi di Oga pata of Oil & Gas to Forin Investmet Network wey de UK. Wen e still dey work for dem, Samuel do meni metin wey kosain Petirol. Di metin wey Samuel do mek 22 kontri, 21 petirol an enaji opuretin kompini an 150 sinior pipo wey get levul join am diskuss . Forbes Afrika tok abaut Samuel for one of dia pej wey get di tahitu "Shaping the future of the continent". Samuel na one of di pipo wey dey rait an edit for Africa Energy & Infrastructure Magazine. Commonwealth Yunivasiti of London join e nem for pipo wey kwulifa to get Honorari Dortoret Digri in lidaship an manejimet. Di Yunivasiti na one online kolej wey dem rejista in Panama.