Tosyn Bucknor

From Wikipedia
Tosyn Bucknor
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am15 August 1981 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos State Chenj-am
Wen e kpai19 November 2018 Chenj-am
Cause of deathsickle-cell disease Chenj-am
PapaSegun Bucknor Chenj-am
Broda an sistaFunke Bucknor-Obruthe Chenj-am
Wok wey e dey dumedia personality, actor Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am
Wen e stat wok2009 Chenj-am
Awod wey e koletBest of Nollywood Awards Chenj-am

Oluwatosin "Tosyn" Bucknor (dey bon am 15 August 1981 an e kpai 19 November 2018) na Naija raita, singa, song raita, redio an televishon host, soshal midiha kreator an a bloga. Na sickla (sickle cell anaemia) bi Tosyn. Onti e kpai , Tosyn dey wok for Inspiration FM as a jonalist. E stil get one organasashon kol These Gene Project to fit helep pipo wey bi sickla.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 15 August 1981 dey bon Tosyn inside one motor. E papa nem na Segun Bucknor an e mama nem na Sola Bucknor. Tosyn papa bi muzikshan. Funke Bucknor wey bi CEO of Zapphaire Events bi Tosyn sista. Tosyn go Fountain Noseri an Pamari skul , [[Queen's College|Kween's Kolej], Yaba, Yunivasiti of Legos (LLB) an di Nigerian Law Skul, Legos Kampos (BL). Tosyn do e youth koppa Nashonal Youth Sarvis Kops in Pot Hakot. Na Litirashon-in- English e Tish for Archdeacon Crowther Memorial Girl Skul wen e dey do youth koppa.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 2009

Tosyn start to dey tok on Redio with Tee A on Eko 89.7 FM. Tosyn kol leta go len wok at Cool FM Nigeria wie e dey tok for Fun Hour Show on Sunday. For 2009, Tosyn join Top FM Redio 90.9 FM an e do tok for "Top of the Morning" onti 2017. Tosyn bi di onli wuman wey dey tok for di hol morin.

  • 2018

Tosyn komot from Top FM go Inspiration FM an na Inspiration FM e dey onti e kpai. Tosin kreate OAP 101 for pipo wey wan bi TV or Redio presenta.