Tony Umez

From Wikipedia
Tony Umez
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemTony Chenj-am
Wen dem bon am23 August 1964 Chenj-am
Ples wey dem bon amOgidi Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am
Academic degreebachelor's degree Chenj-am
Wen e stat wok1993 Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Tony Umez na Naija actor. sinci umez akt for di fim Died wretched Buried in N2.3M casket for 1994, wey mek am popula an bikos of dis fim, i don akt for mo den 200 Nollywood fims of boat inglish an Yoruba languej dem

Hau im tek Stet Im life An Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Tony Umez dem bon am for ogidi Anambra state. Im mama na frum Cross River State an im papa na frum ogidi an na di siam ples dem bon am. ivun as im be ibo pesin di langwej wey im sabi tok pas na Efik wey bi im mama langwej. Umez gro for lagos where i do im primari an sekondari Edukashon i stil go Univaciti wey i get Bachelor's degree an Master's degree for Inglish an intanashonal lau an diplomaci for University of lagos.

Im Aktin Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

I stet to dey akt for im sekondari dais where i paform for steg pla an drama. For 1993 Tony umez kom juin Nollywod. Di fest tu muvi wé im akt no bring am aut so for dis rizin im kom liv for smol tiam. For 1997 im kom bak to di industri kom akt for wan muvi wey di taitu na Di "princess" bot di muvi wey briji am aut wey mek pipu sabi am na "Died Wretched" wey dem rilici for 1998 an dis muvi mek am de popula no bi smol.

Fims Wé Tony Akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Film Role

  • 1997 The Princess
  • 1998 Died Wretched
  • 1999 Pains
  • 2003 Demon in law.