Tony Elumelu

From Wikipedia
Tony Elumelu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Orijina nemAnthony Onyemaechi Elumelu Chenj-am
Fest nemTony Chenj-am
Wen dem bon am22 March 1963 Chenj-am
Ples wey dem bon amJos Chenj-am
Wok wey e dey dueconomist, banker, philanthropist Chenj-am
Post wey e deychairperson Chenj-am
Wie e go skulHarvard Business School, Harvard University, University of Lagos, Ambrose Alli University Chenj-am
Wen e stat wok1987 Chenj-am
AffiliationUnited Bank for Africa, The Tony Elumelu Foundation Chenj-am
Affiliation stringThe Tony Elumelu Foundatio, Heirs Holding Ltd, United Bank for Africa Plc, UBA Group Chenj-am

Anthony Onyemaechi Elumelu CFR ( dey bon am 22 March 1963) na Naija wey dey stodi bizness mata an e dey dash pupi moni an propati. Na Elumelu bi di oga patapata for Heirs Holdings an stil bi di oga patapata for Transcorp. Elumelu bi di fonda of Di Tony Elumelu Fondashon. For 2020, Elumelu nem de for di 100 pipo for di wold wey popula pass. Na Time niuz-pepa do di list.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Jos, Plateau Stet, Naija dey bon Elumelu on 22 March 1963. E papa nem na Dominic Elumelu an e mama nem na Suzanne Elumelu. Elumelu papa kom from Aniocha North lokal govamet aria for Delta Stet. Na four five pikin e papa bon. One of e broda bi Ndidi Elumelu wey bi di manoriti lida in di Nigeria Fediral House of Repisentetiv.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Elumelu rid Ekonomik for Ambrose Alli Yunivasiti. E kari sekod klass lowa (2:2) komot from di yunivasiti. Elumelu kom go Yunivasiti of Legos go do e Masta in Ekonomik. Elumelu give $100 million to di "ony Elumelu Fondashon" to fit yuz am helep pipo get wok in Afrika for di next 10 years. Na 10,000 pipo di fondashon get for mind to helep get wok.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1997, Elumelu lid one smol group of investor to tek ova Crystal Bank. ( di bank kom leta bikom Standard Trust Bank). Wen e tek kontro of Crystal Bank, di bank mek more moni. Femi Otedola give am 20 million Dollars an na dat moni e yuz tek buy UBA.

  • United Bank for Africa

Wen dey join Standard Trust Bank an UBA in 2005, Elumelu bi dia Group Manijin Daretor an e mek suo di bank de for twenty kontri for Afrika, UBA de France, US, an UK. Elumelu stop to bi dia Manijin Daretor in 2010. For now na Elumelu bi di oga patapata for bi board of UBA.

  • Heirs Holding

In 2010, Elumelu form Heirs Holdings, wey bi di e famili bizness. In 2010, e stil form di Tony Elumelu Fondashon, one fondashon wey dey sopot pipo wey wan start bizness for Afrika.

  • Transcorp Plc

For 14 April 2021, forma vais-presidet Yemi Osinbajo give Elumelu di satifiket wey mek am fit dey kontro Transcorp Hotel.

Awod wey e don get[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • In 2003, Fediral Govamet give am Memba of di Orda of di Fediral Riploblik MFR taitu.
  • In 2012, Fediral Govamet give am di Nashonal honor of Komanda of di Orda of di Niger CON for e wok for pravate bizness.
  • Daily Times niuz-pepa give am Nigeria Man of di year in 2016
  • In 2018 an 2019, e kolet di AABLA (All Afrika Bizness Lida Awod filatropist of di year).
  • Bayero Yunivasiti Kano (BUK) give Emlumelu Honorari Doktor of Bizness digree in 2019.
  • E kolet dk Nashonal Prodotiviti Orda of Merit Awod in 2019.

TIME Magazine put e nem for di list of 100 pipo wey popula pass for di wold in 2022.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Elumelu wife na Awele Vivien Elumelu. E wife na medikal doktor. Na 1993 dem do marej an di marej produs seven pikin.