Timipre Sylva

From Wikipedia

Timipre Marlin Sylva CON (dem bon am for 7 July 1964) na Naija politishan an bifor bifor Govnor of Bayelsa Stet weu de Naija. Timipre Marlin Slyva bi di Minista of State for Petroleum Resources for Naija.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Sylva for Brass wey de inside Bayelsa. (Na from Riva Stet dem komot Bayelsa Stet in 1996). E go skul for Bayelsa Stet an Legos Stet. Sylva don bi memba for Rivers State House of Assembly in di 1990s.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Slyva pass out from Yunivasiti of Port Hakot wit distinshon in English (Linguistics) in 1986. Na Slyva no buk pass inside all di studet wey finish dat year for e dipatmet.For 2011, UBIS Yunivasiti give am Doktoret digri in "International Relations (Honoris causa)" Dey stil give Slyva e sekod Doktoret digri (Honoris causa) on di 2nd of December 2020 by AIPA (African Institute of Public Administration) an LBBS.

Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Slyva enta politis for 1992 wen e win House of Assembly eleshon for Brass wey dey inside old Riva Stet. Na Slyva yong pas for inside all di memba of house of Hasebili wey enta.Dey pik Slyva as Speshal Asistans to di Minista of Stet for "Petrolatum" wit di sopot of Dr Edmund Dakouru.E kontinu as Speshal Advaisa onti e komot go PDP go kolet pamari tiket for pipul wey wan bi Govno for Bayelsa Stet in 2006.For di pamari eleshon, na Dr. Goodluck Jonathan win an e kari sekod.Wen PDP kom du dia pamari eleshon for pipul-dem wey go like bi presidor of Naija, dey pik Umaru Musa Yar'adua wey don kpai now an Goodluck Jonathan as e vais.Sins Goodluck Jonathan no fit get two tiket for vais-presidor an Govno, e pik di vais-presidor an rilis di Govno tiket for Slyva. Na PDP win as Govno for di 2007 Bayelsa Stet Govnoship eleshon. Slyva tek ova from di forma Govno wey bi Goodluck Jonathan.For di parti wey dey du so dat e go stat to dey du as Govnor, Slyva tok sey na Bayelsa bi di Stet wey no divelop among di 36 Stet wey dey Naija. Ebitimi Amgbare wey di oponet onda "Action Congress" for di 2007 Govnoship eleshon tok sey e no gri for di risot wey mek Slyva bi Govno.Ebitimi Amgbare kari di mata go kot an di kot kansu di eleshon risot. Di kot tok sey mek Slyva komot as Govno an mek dey mek di Spika of di House Werinipre Seibarugo as aktin govno onti dey du niu eleshon wey happun afta three month. For May 24, 2008, dey du niu eleshon an Slyva wey bi PDP win 588,304 votes of di hol 598,000 wey de kaunt.Dey mek Slyva govno on May 27. On January 27, 2012, Supreme kot rimuv Slyva as Govnor of Bayelsa Stet an dey pik Aktin Govno for di Stet onti February 2012 wey dey du anoda eleshon. Presidor Buhari pik Slyva as Naija kabinet Minista of Stet for petirolium Risosis on August 21, 2019.

Korupshon mata[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta wey dey pass "Petroleum Industry Bill" for August 2021, dey hakwues or blame Slyva sey e wan try bribe Fediral pipul wey dey mek Law even wen Naija pipul no wan somtin wey dey inside di Bill. For one ripot wey dey People Gazette, e tok sey Slyva an Bassey Albert Akpan give moni wey go rish $10,million as bribe. From di $10 million dollar, Sinate Presidet Ahmad Lawal an House Spika Femi Gbajabiamila poket bitwin $1.5 million to $2 million. Meni Fediral pipul wey dey mek law vex on di mata bikos wayo de how dey poker di moni bikos som of dem tok sey na onli $5,000 memba wey dey house of reprisetativ kolet an memba wey dey sinate tok sey dey kolet $20,000. Gbajabiala, Lawal, Akpan an Slyva do BRI komet for di mata.

Awod[chenj-am | chenj-am for orijin]

In October 2022, President Muhammadu Bihari give Slyva one Nashional honor awod wey di nem na Commander of the Order of the Niger CON.