Femi Gbajabiamila

From Wikipedia

Olufemi Hakeem Gbajabiamila CFR (dey bon am 25 June 1962) na Naija lorya an politishian. E bi memba of APC. (All Progressive Congress). Na Gbajabiamila bi di Spika of di House of Repisentativ sins 2019.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Legos in Naija dey tek bon Olufemi Hakeem Gbajabiamila on 25 June 1962. E papa nem na Lateef Gbajabiamila an e mama nem na Olufunke Gbajabiamila. Femi Gbajabiamila go "Mainland Preparatory School" for e pamari skul an Igbobi Kolej for e sekondiri skul. Na for King William's Kolej wey de Isle of Man, in United Kindom Gbajabiamila tek rait e A-Level ezaminashon. Gbajabiamila rid Law from di Yunivasiti of Legos an kolet e Bashelor digree (LL.B) in 1984. Dey kol Gbajabiamila to Naijiria bar in 1984.

Di fest wok wey Gbajabiamila do as lorya na to wok for one law kompini kol Bentley Edu & Co. wey de Legos. E leta go form e law kompini Femi Gbaja & Co. Gbajabiamila kolet e juris Doctor from Atlanta's John Marshall Law School wey de Georgia, USA. E pass di "Georgian bar ezaminashon in 2001 an form law kompini in Atlanta. Wen Gbajabiamila stil dey USA, e put bodi for di eleshon wey Bill Campbell win an Bill Campbell leta kom bi di Mayor of Atlanta.

How e tek join polititis[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2003, Gbajabiamila win to enta "House of representatives" wey e repriset Surulere I Konstitushon of Legos Stet. Gbajabiamila tok sey wetin Nashonal Hasembi memba dey do as dem dey chenj from one politika parti to anoda no gud. E stil tok sey meni pipo wey dey go vote no get koret informeshon abaut pesin wey dey wan vote for an sey na di pesin wey dia parti chuz dem sef dey chuz wen votin. Gbajabiamila don bi di Minority Leader foh di House of representatives in di 7th Nashonal Assembli.

E Wayo-Wayo kase[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta wey dem bon pass di PIB (Petroleum Industry Bill) in August 2021, Gbajabiamila an e frend-dem wey dey mek law na im pipo hakuss sey dey kolet bribe to sopot di law even as Naija pipo no gree to somtins wey de inside di PIB law. Hakordin to wetin People Gazette tok, Timipre Sylva an Bassey Albert bribe di Sinate with moni wey go pass $10 million. Dat time, Timipre Sylva na Minista of Stet for petirol risosis an Bassey Abert na sinator for Akwa Ibom North-East. Di niuz-pepa tok sey na bitwin $1.5 million to $2 million go to Gbajabiamila an di sinate presidor Ahmad Lawan.

Awod[chenj-am | chenj-am for orijin]

In October 2022, forma presidor of Naija, [℅Muhammadu Buhari]] awod Gbajabiamila CFR (Commander of the Federal Republic).

Wia We Si Pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]