The Nation (Nigeria)

From Wikipedia
The Nation
niuz-pepa
Inception31 July 2006 Chenj-am
TitoThe Nation Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Headquarters locationMushin (Lagos) Chenj-am
PublisherVintage Press Limited Chenj-am
Official websitehttp://www.thenationonlineng.net Chenj-am
Terms of service URLhttps://thenationonlineng.net/terms-and-condition/ Chenj-am
Privacy policy URLhttps://thenationonlineng.net/privacy-policy/ Chenj-am

The Nation na Naija niuz-pepa wey dem dey poblish evri day for Legos Stet, in Naija. Akordin to di tori wey The Advertisers' Association of Nigeria (ADVANS) Kari kom for 2011, dem sey na di sekod most popular pepa wey pipul dey rid pass for Naija, an di tori wey dem tok for 2009 folo tok di sem tin.

Di websait of di pepa tok sey dem stand for freedom, justice and maket ekonomik. Dem dey target di pipul wey get moni, wey sabi buk an wey wan go up for life, as dia rida.[1]

The Nation get printi plant for Legos, Abuja and Port Harcourt.[2]

Di niuz-pepa dey rait tori abaut bizness an ekonomik, poblik polisi demokratic process and institutions of demokrasi, sports, arts an kolsho [3]

Di niuz-pepa na di fest of e kind wey wan dey all di 36 Stet of Naija witdin two years wey dey stat to wok. Dis one hapun as risot of di Campuslife poblikeshon wey dem dey distribute on Thursdays with eight pages, wey dey specially dedicate to student journalists and writers wey dey for tertiary institutions for Naija. Di Campuslife pull-out, with di late Ngozi Nwozor-Agbo as pioneer editor, bin help di newspaper bikom popular for evri house for Naija. Plenti studet jonalis an ripotas wey rait inside di niuz-pepa wen dey still de skul don dey popular for dia various professions.[4]

For April 2010, gunmen kill Edo Ugbagwu, one of the ripotas wey dey kova court tori-dem for The Nation. We no sabi wetin korse am.[5][6]

Editos[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Managing Director/Editor-in-chief - Victor Ifijeh
  • Editor - Adeniyi Adesina
  • Deputy Editor - Emmanuel Oladesu
  • Chairman, Editorial Board - Sam Omatseye
  • Editor, Online - Sunday Oguntola
  • Managing Editor, Northern Operation - Yusuf Alli
  • Deputy Editor (News) - Bunmi Ogunmodede
  • Deputy Editor (Nation's Capital) - Onyedi Ojeabor
  • O'seun Ogunseitan[7]

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "About Us". The Nation. Retrieved 2011-05-12.
  2. "The Nation Newspaper". Nigerian Newspaper.com. Retrieved 2011-05-14.
  3. "World-Newspapers > Africa > Nigeria". World Newspapers. Retrieved 2011-05-14.
  4. Ojo, Gbenga (28 May 2015). "Ngozi Agbo: The unforgettable impact - The Nation Nigeria". The Nation, Nigeria. Retrieved 22 February 2017.
  5. "Nigeria: 3 journalists killed in weekend violence". China Daily. 2010-04-27. Retrieved 2011-04-14.
  6. "Names of Editors at the Nation Newspaper". No. VOL.13, NO.4407. Vintage Press Limited. NATION NEWSPAPER. 2018-08-23. Retrieved 26 August 2018.
  7. "Here comes The Nation Archive". Latest Nigeria News, Nigerian Newspapers, Politics. 2014-02-25. Retrieved 2021-06-14.