Mushin (Lagos)

From Wikipedia

Mushin na one of di Lokal Govament Aria for Lagos. Mushin dey for 10km north for di siti Sentra veri near to di main road for Ikeja, an na ples wey plenti plenti pipul dey stey an di aria dey veri dirti bikos di meni hause for Mushin no get toilet.Wen dey kount pipul for 2006, Di pipul wey dey stey Mushin na 633,009.

How di ples bi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Naijá indipedent in 1960 fom Great Britain, plenti plenti pipul kòmórò fom vilej kom siti.Bikos of dis one, mushin kom get too meni pipul an e kom mek pipul dey live for dirti ples an poor aria wit hause wey no too gud.Wen kompini kom dey plenti for Naijá, Mushin sef kom bi pat of di ples wen enjoi fom it.For Mushin, you go see pipul dey du kotin tins,Shu-meka, raid Okada, du milk pawda.Som pipul dey du Agrikulture. Di town na hause wey get hospitu an meni akada(edukashion) like Univasiti an sekondiri skul. Mushin dey bitwin di road from Legos, Shomolu an Ikeja. Mos pipul wey dey stey for Mushin na Yoruba spiking pipul an as e bi so na Yoruba be di komon langwej for di ples.

Di Bandiri wey e get[chenj-am | chenj-am for orijin]

North - Oshodi/Apapa expressway fom Oshodi to flyover liding to intanashional airpot to Oshodi exit into Agege motor road.

South- Bandiri wit Surulere Lokal Govament at di oda side of Bishop Strit to includ Akobi crescent, LUTH, Idi-Araba kommuniti.

East- Agege motor road fom Oshodi to Bishop strit

West - Oshodi - Apapa Expressway to Itire jonshion to include Itire-Ijesha kommuniti in forma Mushin Lokal Govanment.