Tai Solarin University of Education

From Wikipedia
Tai Solarin University of Education
university
Inception2005 Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityIjebu Ode Chenj-am
Coordinate location6°47′34″N 3°55′50″E Chenj-am
Map

Tai Solarin University of Education na one Stet yunivasiti of edukeshion wey dey Naija.Na 2005 dey fom di skul.Di yunivasiti dey Ijagun, Ijebu-Ode, Ogun Stet.

Tori about di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem nem di yunivasiti afta one Naija pesin wey don hep kontrol edukeshion mata an stil don hep human right for di kontri. Di pesin nem na Tai Solarin (1922-1994).Tai Solarin Yunivasiti of Edukeshion bi di nomba 76 yunivasiti wey Naija Govament gri sey mek dey bi koret yunivasiti for di kontri.Tai Solarin Yunivasiti of Edukeshion (TASUED) bikom a konfam Yunivasiti on 29 January 2005 wen Otunba Gbenga Daniel stil bi govno of Ogun Stet. Na Tuesday 28 November 2005, di bodi wey dey kontrol Yunivasiti Nashional Yunivasiti kommision (NUC) agrie to bi one of di Yunivasiti wey dey Naija.TASUED na one beta Yunivasiti wey dey du e best to mek suo sey e train studet wey go bi beta tisha wey go fit tish wel. Di yunivasiti difren smol fom oda yunivasiti bikos na two satifiket di skul dey giv, one for di korse wey pesin go rid as a tisha an di oda satifiket na di hanwok wey pesin dey mek suo sey pesin len for di skul. For April 2009,