Simon Lalong

From Wikipedia
Simon Lalong
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejSimon Bako Lalong Chenj-am
Orijina nemSimon Bako Lalong Chenj-am
Fest nemSimon Chenj-am
Wen dem bon am5 May 1963 Chenj-am
Ples wey dem bon amShendam Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, lawyer Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Plateau State Chenj-am
Wie e go skulAhmadu Bello University, University of Jos, Nigerian Law School Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
ReplacesJonah David Jang Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Simon Bako Lalong CON (dem bon am on 5 May 1963) na Naija lorya an politishian, wey don sarf as govnor of Plateau State fom 2015 rish 2023.

skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta e finish im primari an sekondri skul edukashon in Shendam Lokal Govmet Aria, E kon go skul of Preliminary Studies (S.P.S) Keffi, e pas out in 1986. E kon leta go Ahmadu Bello Univasiti, Zaria, e get lor certikat in 1990. E go lor skul wey dey Legos, wia dem kol am to Bar. E get Masta digre for lor fom di Univasiti of Jos, in 1996.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1998, Lalong stop lor wok kon go dey du politis. wen e dey for People's Democratic partu (PDP), e kari eleshon to enta for Shendem Consistency an na e enta Plateau State Haus of Assembli. In October 2000, na im bi spika of di Assembli, e dey di posishon rish 2006.

Di seven years wey e use for di haus mek am bi pesin wey don sarf as spika pas for Plateau stet histri. Wen e bi spika ba im stil bi two times (2001-2002) chairman for Conference of Spikas of di 36 Stet of Nigeria.

Insaid year 2015, wen di govnor of Plateau stet, Jonah Jang, dey du im sekond time, Lalong dey insaid di pesin wey wan dey im post. E wan bi Plateau stet govnor onda All Progressive Congress (APC). Na im enta an dey sworn am in on May 29 2015.

In March 9 2019 Plateau eleshon an March 23, 2019 suplementri eleshon, na Lalong win re-eleshon as govnor of Pleateau Stet, e get 595,582 vote an pesin wey folo am na, General Jeremiah Hussein of di People's Democratic party (PDP), E get 546,813 votes. Enta as di sekond taim govnor for Pleateau Stet on May 29, 2019. Insaid 2023 genera eleshon, Lalaong trai to enta as senate for Plateau South insaid National Assembly, e lus to Napoleon Bali wey win onda People's Democratic party. Lalong dey insaid pipu wey president Bola Ahmed Tinubu selet as minista.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

In October forma Naija president Muhammudu Buhari giv am Commander of The Order ofThe Niger (CON).

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1.