Sam Loco
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Sam |
Wen dem bon am | 25 December 1945 |
Ples wey dem bon am | Enugu |
Wen e kpai | 7 August 2011 |
Wok wey e dey du | actor, film producer, film director |
Sam Loco Efe (dem bon am on 25 December 1985 - e kpai on 7 August 2021),wey e ril nem na Sam Loco Efeeimwonkiyeke na Naija produsa, daretor an aktor.
How e tek stat life an edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Efe insaid Enugu Stet, Nigeria, na Arase Efeimwonkiyek, wey bi worda pikin. Im papa na fom Benin an e dey wok for Eastern Nigeria an im mama dey sel Akara. E du im smol for Abakaliki, wey kon bi Enugu Stet nau, saut east Nigeria. Efe papa kpai wen e stil dey go skul; na dat wan mek am yuz pas di years wey e sopos yuz for primari skul, sumtims e go fest hep im mama sel Akara bifor e ci moni go skul. First taim e go fest ci aktin na wen som pipu kon du pley for dia skul, e folo dem tok abaut hau e lik to akt. Afta sumtaim e stat to dey akt for skul an na im kon leta bi bes aktor for dia skul. Apat fom di fim e dey akt, e stil sabi pley bol wel wel.
Som of im wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Tom and Jerry (2003) as Papa P (with Chinedu Ikedieze and Osita Iheme)
- Owo Blow (1997) as Baba Landlord
- I'll Take My Chances (2011) as Chief Ekpene
- Final World Cup (2005)
- Long John (2002)
- Ukwa (1995)
- Osuofia in London (2003)
- My Love (2002)
- Ojadike
- I want to harvest you
- The return of anunuebe (2003)
- Things fall Apart (1987)
- Nneka the pretty serpent (1994) as Mazi Nwosu
- Old School (2004)
- A Fool at 40 (2006)
- Blood Billionaires 2 (2005)
- Daddy Must Obey (2004)
- Chief Obwago
- Vigilante (1988)[1] as Sam Efe Loco
How e tek kpai
[chenj-am | chenj-am for orijin]Sam Loco kpai insaid hotel on Sunday morning. Na by fors dem opun di door hotel room wey e dey sleep as e no gree opun am. Pipu neva sabi wetin kil am gangan, dem ci inhaler for im hand an na ontop chair e tek kpai. Di bifor bifor vais president of Actors Guild of Nigeria (AGN), Mr Steve Eboh, wey bi Sam Loco klose frend, tok sey Sam Loco get plan to go im farm for Enugu Stet bifor e kpai dat naight.
Wia dem ci pruf
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "Sam Loco Efe | Actor, Director". IMDb (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2024-06-18.