Peter Okoye

From Wikipedia
Peter Okoye
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Orijina nemPeter Okoye Chenj-am
Fest nemPeter Chenj-am
Famili nemOkoye Chenj-am
Wen dem bon am18 November 1981 Chenj-am
Ples wey dem bon amJos Chenj-am
Broda an sistaPaul Okoye Chenj-am
Wok wey e dey dusinga, YouTuber, singer-songwriter, record producer Chenj-am
Wen e stat wok2003 Chenj-am
Memba ofP-Square Chenj-am
Stai of song abi fimrhythm and blues, Afrobeats, electronic dance music, contemporary R&B Chenj-am

Peter Okoye wey meni pipul sabi as Mr P na Nigeria singa wey dem bon foh 18, November 1981. He stat to dey popular foh di time of 2000s as di memba of di P-Square wit his twin broda wey meni pipul sabi as Rudeboy, foh 2021 dem awod am wit di honor of doktoh digri from di ESCAE University wey dey foh Benin Republic.

Early Laif an Edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Mr. P an e twin broda wey bi Rudeboy grow up for a big family for Jos wey bi Plateau Stet, Nigeria. Dem bon am foh di family of Josephine Okoye and Mazi Moses Okoye.

Peter and e broda Paul join one musik skul and drama klob, na foh di skul dem stat to len how to dance and how to dey sing, and dey even dey pafom di song of som popular musishian dem like MC Hammer,Bobby Brown and Michael Jackson.

E Karia Foh Solo Musik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Foh 2017, him and e broda wey fom di P-Square band kom skata and dem separate. Mr. P fest drop his solo musik wey e nem am For My Head, Cool It Down foh 2017.

Foh 2018, Mr. P join bodi togeda wit Nyanda of Brick & Lace wey dem sing one song wey dey nem am Wokie Wokie. Foh 2021, Mr. P kom fom e own rekod lebel wey e kol PClassic Label, di rekod lebel don sign Naija aktivis and na e bi Dj wey dem dey kol DJ Switch, and foh 2021, e rilis e fest albom wey get 16 trak dem, e nem am The Prodigal wey e join bodi sing wit singa dem like Tiwa Savage, Simi, Teni, Wande Coal, Tamar Braxton, Singah, Mohombi, DJ Switch, and OvieKelz.

Pasona Laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Foh 2013, Peter Okoye and e girlfriend dat time wey bi Lola Omotayo giv bet to dia daughter Aliona foh one hospital wey dey San Francisco foh United States. Wen e rish 17 November 2013 di two of dem kom marri foh di Ark foh Lekki, Legos stet, Nigeria.

Wie Dem Gada di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]