Olu Jacobs

From Wikipedia
Olu Jacobs
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemOlu Chenj-am
Famili nemJacobs Chenj-am
Wen dem bon am11 July 1942 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbeokuta Chenj-am
Pesin wey e mariJoke Silva Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor, television actor Chenj-am
Wie e go skulRoyal Academy of Dramatic Art Chenj-am
Wen e stat wok1970 Chenj-am

Oludotun Baiyewu Jacobs (Dem bon am for 11 July, 1942) na Naijá Aktor wey dey akt an mek fim.Pipu sabi am wel as Olu Jacobs.E don akt for plenti fim wey Oyinbo pipu du.Plenti pipu dey salut am say na em dey amog pipul wey dem rezpet pas for Afrika for fim aktor.Pipul wey dey akt fim lik am,meni pipul wey dey rit abot fim don gree say Olu Jacobs dey amog Obonge aktor wey pipul sabi pas for Afrika,an na beta ezampul wey oda aktor sopoz dey folo for am to tich dem to sabi akt.Plenti pipu don gree sey Olu fit akt wit yong Aktor an Old aktor wel wel for muvee.Jacobs don dey inside Naijá fim wey dem dey kal Nollywood e don pas 40 years now an dat is di rezin dey tok sey e Sabi di old pipu an yong aktor-dem.Olu Jacobs get training for The Royal Academy of Dramatic Arts for England. Olu Jacobs wok for plenti Oyinbo pipul wey dey wok resembu e wok an e folo dem akt fim. For 2007, e win awod for African Movie Academy Award as persin wey akt Wel Wel for fim.Olu Jacobs don akt wel wel for fims wey e dey du wey mek am bi beta ezampul for niu pesin wey wan to de akt fim.Wetin mek am do wel Wel na bikos of sey e dey luk persin wey dey akt wel wel lik Herbert Ogunde.