Noni Madueke

From Wikipedia
Noni Madueke
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromEngland Chenj-am
Fest nemNoni Chenj-am
Wen dem bon am10 March 2002 Chenj-am
Ples wey dem bon amLondon Borough of Barnet Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitymidfielder Chenj-am
Wie e go skulSt Columba's College Chenj-am
Member of sports teamTottenham Hotspur F.C. Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am

Chukwunonso Tristan "Noni" Madueke (dey bon am 10 March 2002) na England futbols wey dey play for Premier Ligi klub Chelsea. Madueke fit play as winga or as midfida.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Igbo peret bon Madueke an na for Barnet dey bon am. Wen PSV klub sahin am, Madueke an e mama pak komot go one vilej kol Wintelre.

How e tek play futbol[chenj-am | chenj-am for orijin]

Madueke join Crystal Palace wen e stil bi nine year old an e yuz three yearsbfor di klub. E leta join Tottenham Hotspur wey e kaptain di onda-16 side. Wen Madueke bi 15 years old, e play for di onda-18 side.

  • PSV

Madueke sahin three years kontact with PSV. PSV na one klub wey de Holland. Dat time Manchester United wan sahin im but Madueke no gri go.

On 26 August 2019, Madueke play for di sinior tim of PSV wen in di Eerste Divisie . Dey chenj Jong PSV in di 64 minit for Madueke for dat game. MVV Maastricht win PSV 1-0 for dat game. Madueke play for di fest tim of PSV on 19 January wen dey play 1-1 draw with VVV-Venlo. Madueke kom dey play evritime for PSV in di 2020-21 sisin. For di fest game of 2020-21 sisin, Madueke score wen PSV win Emmen 2-1 on 19 September 2020. Na seven goal e get for dat sisin.

For 7 August 2021, Madueke score two goal in di 4-0 will against Ajax. Na Ajax nomba 18 game wey dey neva loss onti PSV win dem. Madueke sahin anoda kontact win PSV onti 2025. PSV give Madueke jersi nomba 10.

  • Chelsea

On 20 January 2023, Chelsea futbol klub sahin Madueke an sey e go de with dem for seven an a half year. Chelsea give PSV £28.5 million. Madueke score e fest gil for Chelsea wen Chelsea win Arsenal 3-1 on 2 May 2023.

How e tek play for Kontri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Madueke don play for England youth tim . E score two goal wen England wan kwulify against Denmark onda-17. E de di tim wey play 2019 Europian Onda-17 Shampionship Madueke play e onda-18 game for England wen dey play Australia. Na 3-2 England win dem. Na for De Montfork dey play di game on 6 September 2019. Madueke score in di 2-0 against South Korea on 10 September 2019. On 15 March 2021, Madueke nem de di tim wey go play 2021 UEFA Europian Onda-21 Shampionship