Nadia Buari

From Wikipedia
Nadia Buari
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromGana Chenj-am
Nem for lokal langwejNadia Buari Chenj-am
Fest nemNadia Chenj-am
Famili nemBuari Chenj-am
Wen dem bon am21 November 1982 Chenj-am
Ples wey dem bon amSekondi-Takoradi Chenj-am
Unmarried partnerJim Iyke Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Ghana, Mfantsiman Girls Senior High School Chenj-am
Academic degreebachelor's degree Chenj-am
Academic majorperforming arts Chenj-am
Wen e stat wok2005 Chenj-am
Awod wey e koletAfrica Movie Academy Award for Best Actress in a Leading Role, Special Recognition Award Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Nadia Buari (dem bon am for November 21,1982) na aktres from Ghana. E kolet two nominashon for Best Actress in a Leading Role for di Africa Movie Academy Awards for 2009.

How e tek start Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Buari for Sekondi-Takoradi, Ghana, e papa na Lebanese and e mama na Ghana wuman. E go Mfantsiman Girls' Secondary School an den stodi performing arts for di Univasiti of Ghana, Buari kom finish wit a BFA digri. All di time wey e dey Univasiti for Ghana, e dey aktiv for drama an klub wey dey dans.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Buari fest show for Ghana nashona television wit TV show wey bi Games People Play for di late 2005. E fest mejo fim na Mummy's Daughter. Na afta dat one, Buari kom de inside Beyonce: The President's Daughter. Di role wey e akt as Beyonce na dia kom mek am popula wel wel. E Karia for muvi stat wen e akt one role for di TV series Games People Play for 2005, wey mek dem chuz am as di best aktres. She don show for more dan 20 muvis. For 2013, Buari do e own muvi wey e give Di taitu The Diary of Imogene Brown.

E susses and how she take make am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Buari komot for Ghana fim enta Nollywood film for di year 2008. Di fim wey e dey inside for Nollywood na Beyonce & Rihanna na Beyonce wit Nollywood aktres Omotola Jalade Ekeinde wey akt di role as Rihanna. Di fim kom popula wel wel for in Ghana and Naija. Buari akt oda fim like Rough Rider, Beauty and the Beast, Holding Hope and Single and Married. Dem olso no Buari for fim wey e akt

wit Nollywood aktor wey bi Jim Iyke, wey don make am popula more. Fim like di Beyonce & Rihanna film series, Hot Romance and Behind a Smile. For 2013, Buari win di Pan African Actress award at the annual Nigerian Entertainment Awards (NEA Awards)  for New York City.

Oda work wey she dey do[chenj-am | chenj-am for orijin]

Buari com be ambassador for Tablet India Limited (TIL) for 2013.

Ha Pasona Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

for 2019, Buari talk for one intaviu say she don marri and she don bon four pikin.

Awod wey she get[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2014, Buari kolet di awod for di Special Recognition Award at Africa Magic Viewers Choice Awards.

Some of Ha Film Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Beyoncé — The President Daughter (2006)
  • The Return of Beyoncé
  • Mummy’s Daughter
  • Darkness of Sorrow (2006)
  • Slave to Lust
  • In The Eyes of My Husband
  • American Boy
  • Wicked Intentions
  • Tomorrow Must Wait
  • Hidden Treasure
  • Beyonce & Rihanna
  • Beauty and the Beast (2008)
  • My Last Ambition
  • Love, Lies and Murder
  • Secret Lie
  • The Angle Against The Monster
  • Heartless
  • Last Hour Romance
  • Under My Pillow
  • Speechless
  • Desperate Bride
  • Innocent Sin
  • Guilty Threat
  • The Golden Lady
  • Satanic Kingdom
  • Rough Rider
  • Crazy Scandal
  • Unfaithful
  • The Monster In Me
  • Bad Egg
  • Garden of Eden
  • No More Love
  • My Dove
  • Agony of Christ (2009)
  • Heart of Men (2009)
  • Forbidden Fruit (2009)
  • Holding Hope (2010)
  • Chelsea (2010)
  • Checkmate (2010)
  • Single and Married (2012)
  • Heroes & Zeros (2012)
  • Game Plan (2015)
  • American Driver (2017).

Wia We Si Pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]