Moshood Abiola National Stadium

From Wikipedia
Moshood Abiola National Stadium
association football venue, FIFA
Inception2003 Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityAbuja Chenj-am
Coordinate location9°2′17″N 7°27′12″E Chenj-am
ArchitectSchlaich Bergermann Partner Chenj-am
Date of official opening2003 Chenj-am
OccupantNigeria national football team Chenj-am
Map

Moshood Abiola National Stadium (wey pipul sabi bifor as National Stadium, Abuja) na ples where dem dey du meni tins, wey dey insaid Abuja, Federal Capital of Naijà. Di ples na home fo Naijà National futbol teem, an na stil ples fo gadarin fo culture an chorch tins. Naijà Govment apruve di kontrat to du di Stadium on 18 July 2000. Dem du di Stadium bicos of 8th All Afrika games wey stet on October 2003. Fo 12 June 2019, President Muhammadu Buhari anours di chenj of nem fo di National Stadium, Abuja to Moshood Abiola National Stadium. President Muhammadu Buhari chenj di nem wen e dey giv Presidential spich fo Democrgacy Day Celebrashion on Wednesday fo Moshood Abiola Stadium (wey pipul sabi bifor as National Stadium, Abuja) na ples where dem dey du meni tins, wey dey insaid Abuja, Federal Capital of Naijà. Di ples na home fo Naijà National futbol teem, an na stil ples fo gadarin fo culture an chorch tins. Naijà Govment apruve di kontrat to du di Stadium on 18 July 2000. Dem du di Stadium bicos of 8th All Afrika games wey stet on October 2003. Fo 12 June 2019, President Muhammadu Buhari anours di chenj of nem fo di National Stadium, Abuja to Moshood Abiola National Stadium. President Muhammadu Buhari chenj di nem wen e dey giv Presidential spich fo Democrgacy Day Celebrashion on Wednesday fo Eagle Square, Abuja.

Hau dem tek du am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Moshood Abiola National Stadium na one of di 50 Stadium wey cost pas fo di world[1]

How di stadium luk like[chenj-am | chenj-am for orijin]

Moshood Abiola National Stadium fit kolet 60,491 persin, dem kova am wit roof wey no too heavy. Di Stadium get two ples wey pipul wey dey wotch bol fit sit; Di wan wey dey low get 32,000 seats an di up kon get 28,000 seats. Di one wey dey low get 56 koporate ples wey persin fit dey wotch bol, di stadium kon stil get one ples difiren wey dey fo President or oda top pipul, na 50 persin di ples fit tek. All di ples wey dey fo Ceremony an oda tins floor na 25,000 m². Di ples fo pipul wey wan watch bol get one smol ples onda wey get diferen kiosk, banks, an toilet. Na concrete an situ dey uze du di stadium. Na 36 strong tol pole dey uze sopot di roof. Di tol tins wey hod am get 140 piles wit diameta of 1.30m an 1.50m.

Weyin dey inside di stadium[chenj-am | chenj-am for orijin]

All di tins wey dem uze fo di stadium na origina an di International sport association, Federation International de Football Association (FIFA) an di International Association of Athletics Federation (IAAF) folo komfam am.

  1. Di stadium get:

.60,491 persin fit dey insaid

.Velodrome wey bicycle fit pas

.ples where President an oda impotant pipul fit dey

.Post Ofis

.Banks

.where nius pipul fit dey (media)

.shops

.3000 ples where dem fit du insaid sport

.Swimming ples wey fit tek 2000 pipul

.Tennis ples (court)

.Hockey ples wey fit tek 3000 pipul

.ples where dem fit pley Baseball

Di committee wey dey chek stadium fo di wod tok sey di Stadium na Wod klas bikos e stil gat ples lik: wen emergency hapun tins wey don dey redi, Camera wey dey ci everibodi, an e get fence wey dey pipul. Di stadium get tins wey dem fit uze kontrol fire an stil get somtin wey dey let dem no wen fire don stet.

Histri abaut di Stadium[chenj-am | chenj-am for orijin]

Naijà get meni stadium fo di kontri, no bi hol of dem get wetin go mek dem standard fo di wod. Naijà capita citi Abuja, dem selet to host di 8th All Afrika Games in 2000 (sport wey dem dey du evri 4 years, wey Association of National Olympic Committee of Afrika dey oraganise). Federal Govment fo Naijà kon diside sey mek dem du one stadium fo Abuja bikos of di All Afrika Games. Na 18 July 2000 dem giv one kontrator di kontrat, na 80 kontractor tel govment sey dem won du di Stadium bifor govment giv one of dem.

Plenti pipul an sport pipul dey fear sey di stadium go finish bifor game go stet. Wok stet an finish bifor di game stet. Na di stadium sef dem tok sey dem go tek du Miss World Beauty Pageant wey hapun fo year 2002. But dem no lata du am fo di stadium bikos of di fight wey hapun fo Kaduna wey pipul die na im mek dem kari dey Miss World pageant go London, England. Dey stet to dey du di stadium fo September 2000 an kon finish am fo April 2003, bifor di game stet. Di game vilej kon Alstet fom September 2000 to August 2003.

Dem open di stadium fo pipul to dey uze am on 8 April 2003. Afta dey open am dem pley match to yuz test am fo di game. Dat year bi di year wey pipul plenti pas fo All Africa Game histri; 6,000 pipul wey dey du sport fom 53 kontri wey tek pat fo 22 sports, 1,200 wey dem sabi sport persin see di game. E pass 1,500 pipul wey dey writ or tok abaut sport tok or writ abaut di game fo di wod. Di game stet on di 4th to 18 October 2003 an plenti pipul tok sey evritin go wel. Naijà wey bi di host kontri get 226 medals, na dem kolet medals pas dat year.

No bi onli All Africa Games, dem don du fo di stadium. Dey don pley big matches fo di stadium, ezampu na World Cup qualifiers wey Naijà an oda kontri don pley. Di first match wey dem pley fo di stadium na futbol match wit lokal klub wey bi: Shooting Stars of Ibadan an Sunshine Stars of Akure on 8 April 2003. Di first goal na fom Shooting Stars playa Shakiru Lawal wey skore di onli goal fo di match afta 5 minutes.

Di niu stadium wey di kontri get don hep dem host difren events lik; 2007 World Youth Championship wey bi fo Volleyball game.

Oda tins ewu dem de yuz am for[chenj-am | chenj-am for orijin]

Som oda tins wey dey hapun fo Moshood Abiola National Stadium na cultural an chorch event. Bikos of how di Stadium bi pipul lik to dey yuz am fo event. somtims chorch event dey hapun bifor sport tins. For ezampu, insaid September 2006, Nigeria Football Federation no fit du enitin wen Naijà get match wit Rwanda, an President tok sey mek dem du event an mek foootball wait first. Plenti pipul don tok sey e no gud as dem dey yuz am fo event, but di moni wey dem dey pay fo di event na fo di stadium maintenance.

Maintenance[chenj-am | chenj-am for orijin]

Meni pipul dey wori abaut how dem go tek maintain di stadium. National stadium fo Lagos wey dem du fo All Afrika Games 1973 no fine lik bifor bikos no maintenance. Amos Adamu wey bi forma Minista fo sport advis President sey mek dem giv privat pipul di Abuja National Stadium bikos dem go maintain am wel.

Di money wey dey don yuz maintain d stadium sinc di time dey don du am don reech $7 millon, wey plenti pipul don tok sey e too much fo maintenance. Bikos of di plenti moni fo maintenance Federal Govment of Nigeria kon dside to find private compani wey go dey manaj am.

Chenj of nem[chenj-am | chenj-am for orijin]

On June 12, 2019 President Muhammadu Buhari renem di national stadium Abuja afta 1993 Presidential election fo Naijà winna, Moshod Abiola. Meni pipul gree sey na Mr Abiola win di June 1993 election, but di forma Military Govment of Ibrahim Babangida kansu am. President Buhari fo 2018 giv Mr Abiola respet wen e giv am di Grand Commander of di Federal Republic wey bi di honor wey big pas fo Naijà. Wen President Buhari dey giv tok fo di chenj of nem event, wey stil bi Naijà 20th year of Democracy, President Buhari tok sey di niu stadium nem na Moshood Abiola National Stadium. Di event hapun fo Eagles Square an na plenti big pesin dey dia lik di president of Rwanda, Paul Kagame.

Big matches wey don hapun fo dia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Date Team 1 Result Team 2 Attendance Round
24 October 2009 Honduras 0–1 Argentina 19,560 Group A
Nigeria 3–3 Germany 21,300
27 October 2009 Argentina 2–1 14,400
Nigeria 1–0 Honduras 42,900
30 October 2009 Germany 3–1
Switzerland 1–0 Brazil 4,250 Group B
5 November 2009 Nigeria 5–0 New zealand 35,200 Round of 16
15 November 2009 Colombia 0–1 Spain 40,000 Third place match
Switzerland 1–0 Nigeria 60,000 Final

See also[chenj-am | chenj-am for orijin]

References[chenj-am | chenj-am for orijin]

External links[chenj-am | chenj-am for orijin]

Templet:Coord Templet:S-start Templet:Succession box Templet:S-end Templet:Abuja Templet:Football in Nigeria Templet:Nigeria national football team