Mele Kyari

From Wikipedia
Mele Kyari
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemMele Chenj-am
Famili nemMele Chenj-am
Wen dem bon am8 January 1965 Chenj-am
Ples wey dem bon amNaija Chenj-am
Fest langwejKanuri Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Kanuri, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumilitary personnel, geologist Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Maiduguri Chenj-am

Mele Kolo Kyari OFR ( dey bon am 8 January 1965) na Naija sayentis wey dey dig ground to find miniral risosis. Kyari na also Crude orye maketa an "1st Group Chief executive Officer" (GCEO) of di NNPC ( Nigerian Nashonal Petirolihom Kompini Limited). Bifor Kyari bi di oga patapata for NNPC, e don bi di Group Jeneral Manija, Krude Orye Maketin Divishon of di NNPC. Na Kyari still dey go tok for Naija for OPEC ( Organization of Petroleum Exporting Countries| Organasashon of Petirolihom Expotin Kontri]] sins 2018.

=How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Maiduguri wey de Borno Stet dey bon Mele Kolo Kyari on 8 January 1965. E go Govamet Kommuniti Sekondiri Skul Biu wey de Borno Stet bitwin 1977 go rish 1982. Kyari go Yunivasiti of Maiduguri go rid Jiholoji an Earth Sayens in 1987.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Maikanti Baru ritaya from NNPC, forma presidor Muhammadu Buhari chuz Kyari as di nomba 19 pesin to bi di jeneral manija of NNPC. In 1991, Kyari join di NNPC prosessin Jiofisist with intagreted Data sarvis limited. Kyari in 1991, Kyari start to wok as Field Jiologist with Dipatmet of jiolojikal soviho of Nigeria. In 1998, Kyari wok as "Exploration Geophysicist" with di NAPIMS (Nashonal Petirolium Investimet Manijimet Sarvis]]. Na Kyari kontro di Prodoshon Sharin Kontat Manijimet in (COMD) (Krude Orye Maketin Division ) in 2014. In 2015, dey mek Kyari di Group Jeneral Manija of COMD.

Awod-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Order of the Federal Republic (OFR): In October 2022, President Muhammadu Buhari give a nashonal honour of di Order of the Federal Republic (OFR)" to Kyari.
  • Outstanding Employer of The Year 2022 Award: Kyari kolet di outstanding employer of the year 2022 awod wey Trade Union Congress of Nigeria (TUC) do for April 2023.